Wen be Champions League last-16 draw & how e go work?

Read am in 4 mins

You dey enjoy di new Champions League format?

Di new league table and play-off phase go complete afta Wednesday action, and we go return back to a 'normal' last-16 knockout for Europe top club competition.

However, unlike previous years, a significant part of di draw don already happun.

Wetin remain for Friday draw na to decide who be di seeded teams - wey finish first to eighth for league phase – go face and which half of di draw dem go dey.

You fiit watch di Champions League last-16 draw for SuperSport channel for DSTV if you dey Nigeria on Friday, 21 February from 12pm West African time and follow our live text coverage for BBC Pidgin website.

Followed by updates from di Europa League (1pm) and Europa Conference League (1pm) draws.

Dem expand di Champions League format dis year wit more games from 125 to 189. Di final go take place for Munich on Saturday, 31 May.

Seeded teams, away goals, clubs from di same kontri

  • Teams dey seeded in couples - so for example Liverpool (1) and Barcelona (2) go dey on separate sides of di draw, dem no go fit meet until di final
  • Teams from di same kontri fit meet each oda at any point
  • No away goals rule, Uefa bin remove am for di start of di 2021-22 season dem say e "no longer dey appropriate" for dem "to carry more weight".

Which clubs dey di round-of-16?

Di clubs wey finish for di top eight of di league phase go directly through to di round of 16, along wit di winners of di first four knockout playoff (KO-PO) round ties.

  • Arsenal
  • Aston Villa
  • Atlético Madrid
  • Barcelona
  • Bayer Leverkusen
  • Bayern Munich (KO-PO)
  • Benfica (KO-PO)
  • Club Brugge (KO-PO)
  • Feyenoord Rotterdam (KO-PO)
  • Internazionale
  • Lille
  • Liverpool

Dem go dey joined by di final four winners of di knockout playoff round ties, wey feature di clubs placed ninth to 24th, di second legs dem go play am on Feb. 19.

Brest vs. Paris Saint-Germain (first leg 0-3)

Manchester City vs. Real Madrid (2-3)

Juventus vs. PSV Eindhoven (2-1)

Sporting CP vs. Borussia Dortmund (0-3)

Clubs wey finishing 25th to 36th chop elimination at di end of di league phase.

Who Liverpool fit face?

As e be say Paris St-Germain get strong first-leg lead ova Brest, Liverpool dey set to face either PSG or Benfica - depending on Friday draw.

Who Arsenal fit face?

Arsenal fit face either Feyenoord, wey knock out AC Milan, or di winners of Juventus v PSV tie.

Who Aston Villa fit face?

Aston Villa go play either Club Brugge or di winners of Borussia Dortmund v Sporting tie, wia di German side hold a commanding 3-0 first-leg lead.

Who Man City fit face?

Manchester City potential opponents - if dem fit win Real Madrid for di play-off - go be either Atletico Madrid or Bayer Leverkusen, two of di seeded teams.

Wen be di round of 16 fixture dates?

First legs: March 4-5

Second legs: March 11-12

Each club go plays once on a Tuesday and once on a Wednesday.

Wetin be di dates of di oda rounds?

QUARTERFINALS

First legs: April 8-9

Second legs: April 15-16

SEMIFINALS

First legs: April 29-30

Second legs: May 6-7

FINAL

May 31, Allianz Arena, Munich