You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Cameroon President Biya, 92, wan run for eighth term
Cameroonian President Paul Biya, wey don dey near 100 years, say im wan run for im number eight term for office.
Biya wey already dey 92 years, don be president of Camerron since 1982 till now, im be di world oldest head of state.
Im bin win one seven years term for 2018, for elections wey many of di kontri pipo no gree show to cast dia vote, plus accuse of irregularities.
Biya forever stay in office, na sake of one controversial amendment wey di kontri bin do for dia constitution for 2008 wey bin remove presidential term limits.
Inside one post wey im do for X yesterday, Oga Biya say: "I be candidate for 12 October 2025 presidential election. Rest assure say my determination to serve you dey commensurate wit di serious challenges wey dey face us. Togeda, e no get challenges wey we no fit meet."
"Di best still dey come," im say.
Im announcement dey occur as two of im long-term staunch supporters distant diasef from am for June.
Di two former supporters, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari don already declare dia own candidacies for position of president .
Issa Tchiroma Bakary wey bin be prominent minister for Biya goment bin stop to support am in hope say e go end di 92-year-old forty years grab to power for di October elections.
Tchiroma wey switch go one rival say: "A kontri no fit exist for di service of one man."
Im bin serve as tok-tok pesin for Biya goment, and until e resign for June dis year, im bin dey serve as di kontri employment minister.
Bello Bouba Maigari wey bin be di Biya former prime minister, previously challenge am for di 1992 election, but later join im regime.
Maigari, 78, wey be Cameroon long-time Tourism Minister, formally announce say im dey run for president without stepping down from in post for Biya cabinet.
News don dey fly upanda for some time now about di health condition of di president.
For October 2024, Cameroon authorities ban media from discussing di health of president afta one rumour bin dey fly upanda say im don die.
Interior Minister Paul Atanga Nji bin tell regional govnors say dis kain tori dem dey "disturb di tranquillity of Cameroon pipo".
Im add say: "Any debate for media about di president condition diafor dey strictly forbidden," come threaten say "offenders go face di rigour of di law."
Di president still dey make im frequent private trips abroad and dem dey even describe am as "honorary citizen" of Geneva.
Presidential hopefuls get until 21 July to submit dia candidacies for di 12 October election.
Maurice Kamto wey bin come second for di 2018 presidential election, dey expected to contest again and im go be Biya greatest challenge.