Tori of multibillion naira presidential yacht wey Lawmakers comot from supplementary budget

Wia dis foto come from, Presidency
Di House of Representatives don drop di N5billion ($6million) presidential yacht from di 2023 supplementary budget.
Chairperson, House Committee on Appropriation, Abubakar Bichi na im announce dis on Thursday afta di passage of di N2.17 trillion supplementary budget by di House.
Oga Bichi, tell tori pipo say, say di committee bin remove di item and move di money to di student loan section to make am N10billion.
Di proposal to buy Yacht bin cause tok-tok amongt Nigerians, many pipo condemn di move.
Abubakar Bichi for im tok, say di budget for di presidential Yacht don dey transferred to student loans.
“As far as we dey concerned we no need to have presidential yacht anymore. We don increase di student loan”, e tok.
“If you recall, di student loan be N5 billion for di budget but we don increase am to N10 billion.
Di proposed moni for di presidential yacht for di supplementary budget bin dey under di capital expenditure of di Nigerian Navy budget.
End of Di one wey oda users dey read well well
On Thursday di Senate pass di N2.17 trillion 2023 Supplementary Budget wey President Bola Tinubu propose.
But e no clear whether dem effect di change wey di House of representatives make on di removal of di presidential yacht from di budget.
President of di Senate Godswill Akpabio announce di approval of di bill afta majority of di Senate support am through one voice vote for di plenary on Thursday.
Na for di Senate Committee of Supply senators decide di supplementary budget bifor e dem announce am.

Wia dis foto come from, Getty Images
Presidency give facts about Presidential Yacht
Presidency tok say presidential yatch na operational name of one Naval boat.
For statement wey president tok-tok pesin Bayo Onanuga sign, presidency say e dey important to clear di mind of di public sake of di reactions wey di mata of di presidential yacht don cause.
E say di presidential yacht inside di budget na Operational Naval boat wit specialized security gadgets wey dey for high profile operational inspection and no be for di use of di President.
Dem dey call am presidential yacht by way of nomenclature sake of im high level security features, e add.
Oga Onanuga also say di Naval boat dey ordered by di navy under di previous administration, "President Tinubu don consistently tok say goment na continuum as e bin inherit both assets and liabilities of past administrations.
"Di payment request for di boat na part of di committed obligation wey office of di Chief of Naval Staff bin submit to di Ministry of Defence. Di total of di submitted requests na excess of N200 billion out wey N62 billion dey approved by di President."
How Nigerians react to di N5 billion presidential yacht
Wen tori bin comot say federal goment dey plan to spend N5 billion to purchase one presidential yacht for di 2023 Supplementary Budget.
Nigerians bin no take am easy at all, many pipo bin enta social media to react to di plans.
Many of di comment for social media bin try ask why federal gomment go reason to buy Yacht of N5 billion for di kontri current economic condition.
Some of di comment bin borrow goment some advise about wetin to do instead, while some comments no too good sake of how abusive dem dey.
But di point be say di idea of presidential yacht proposal no go down well wit Nigerians.
Celebrites also chook dia voice for di call faor di federal gomment to reconsider di move wey dem tag as insensitive.
One of di popular voice wey chook mouth for di matta na comedian, Oluwaseyitan Aletile wey pipo sabi as Seyi Law.

Wia dis foto come from, Seyi Law/X
Part of di expenditures wey di president bin propose for di 2023 supplementary budget to di National Assembly for approval include N5.095 billion on a presidential yacht.
Di proposed money bin dey under di capital expenditure of di Nigerian Navy budget.
According to breakdown, di Navy go require N62.8 billion for dia operations, wit recurrent expenditure and capital expenditure to gulp N20.4 billion and N42.3 billion, respectively.
Meanwhile di Presidency bin deny di tori.
“E dey important to state clearly say di President Bola Tinubu no ask for presidential yatch and I doubt say e need one to perform di functions of im office,” President tok-tok pesin Temitope Ajayi bin tok for statement.
“From wetin I know, di request for yacht, however wey dey named or couched inside di budget na from di Navy and dey must get operational reasons why e dey required.
However, di latest tori say House of representatives don throway di proposal meet Nigerians well.
For di second time on di same matta, kontri pipo don rush go social media to hail di federal gomment say na beta move.
Dem say dis one mean say goment dey listen to wetin Nigerians dey tok.














