Mohbad: Iyabo Ojo reply Naira Marly, demand 1 billion naira

Wia dis foto come from, Facebook/NairaMarley/Mohbad/Iyabo Ojo
Nigerian actress Iyabo Ojo don demand one billion naira from Naira Marley say im lawyer no serve am di pre-action letter before e begin dey trend for social media.
Naira Marley lawyer bin send out a pre-action notice wia e dey demand 500 million as damages for how Iyabo Ojo bin allegedly link im client for di death of Ilerioluwa Aloba wey dey popularly known as Mohbad.
Iyabo Ojo wey release her own response for 18 December 2023 tok say dem no deliver di letter to her but she begin dey see am for social media.
According to di law firm ‘The Maverick Forte Legal’ wey dey represent Iyabo Ojo, dem dey ready to present witnesses wey go testify for court ontop di allegations wey dem sama Naira Marley if di mata pass di level wey e be.
Iyabo Ojo bin insist say Naira Marley lawyer no serve her di letter wia e dey drag her for defamation before e come demand 500 million damages.
She dey demand 1 billion as she claim say di public letter don make her lose income and standard for di society.
“Our client (Iyabo Ojo) find say your client (Naira Marley) demand dey frivolous and na clout chasing. Our client (Iyabo Ojo) go claim one billion naira for deliberately misleading di public say e serve her letter. Di public letter don lead to grievous loss of income and lower her standard amongst Nigerians,” Iyabo Ojo lawyer tok.
For one letter wey circulate for 12 December 2023, di lawyer Olalekan Ojo wey dey represent Naira Marley confam to BBC Pidgin say dem don truly begin legal against Iyabo Ojo and demand public apology wey she go post for her Instagram page.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di lawyer Ojo Olalekan say Iyabo Ojo bin use her Instagram account to defame Naira Marley for September 2023 wey be di same month wey Mohbad bin die.
For di letter, Naira Marley claim say Iyabo Ojo accuse am of dealing wit Mohbad ‘spiritually, mentally and physically’ and e don expose am to ridicule for di public.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Naira Marley demand 500 million in damages
Olalekan bin say Iyabo Ojo need to publish public apology to Naira Marley and e need to dey posted on her Instagram handle ‘iyaboojofespris’ and national newspaper within seven days wey dem write her di letter.
If afta di stipulated period Iyabo Ojo neva tender di apology, Olalekan say Naira Marley go dey forced to demand 500 million naira for damages.
“Our client dey propose say make you communicate your terms wey go help wit amicable resolutions within seven days wey dis letter come out or our client go begin legal proceedings without any consideration.”












