MTN don increase dia data prices?

Wia dis foto come from, Getty Images
MTN, Nigeria biggest telecommunication network don confam increase for di price of dia data bundles.
Di telecommunication company tok dis one as dem dey respond to dia subscribers complaint on X, as dem dey lament di hike in di price of data plan bundles.
For di response, MTN tok say di price adjustment na to enable dem serve subscribers beta, and dem regret any inconvenience.
"Yhello, sincere apologies for data price review. Di price adjustment na to enable us serve you beta." Di statement read.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Nigerians wey dey use di telecom network bin para on social media wen dem notice say di price of data bundles don change.
Di price of weekly, monthly and oda data bundles change to a more higher price.
Weekly 15GB increase from 2,000 to 6,000 naira. Dem also adjust dia monthly data plans. 1.5GB wey be 1,000 naira bifor now na 1,200 naira. 20GB now na 7,500 from di 5,500 wey e be bifor.
Di 1.5 terabyte 90-day plan don rise from 150,000 naira to 240,000 naira, and di 600GB 90-day plan now na 120,000 naira, up from 75,000 naira, according to di updated list.

Wia dis foto come from, MTN

Wia dis foto come from, MTN

Wia dis foto come from, MTN

Wia dis foto come from, MTN

Wia dis foto come from, Getty Images
Although, MTN neva release any official statement about di increase, but di prices don change on dia website.
Subscribers only sabi wetin dey happun wen dem try buy data few hours ago.
Dis dey make many of dem para on social media.
One MTN employee confam to BBC say di charges don increase but dem dey wait for official communication from dia company.
BBC don contact MTN for more informate on di changes.
E neva clear wen oda telecommunication networks like Airtel and Glo, wey also be major telecoms for di kontri go increase dia prices.
Plenty reactions don follow dis increase on social media, as pipo say dis increase fit cut off many pipo, as e dey come wen di kontri hard.
One wey dey trend pass na di MTN 15GB weekly bundle from 2,000 naira ($1.33; £1.08) to 6,000 naira ($3.99).
"Which kain plenty increase be dat?... Just making sure say di masses suffer more," one commenter on X tok.
"Triple di amount? End time dey close," anoda pesin write.
Subscribers also complain say MTN 1GB bundle don double more dan di price.

Wia dis foto come from, X screengrab

Wia dis foto come from, X screengrab









