You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Court issue Form 48 against pro Wike lawmakers as FCT minister, Sim Fubara fight take new dimension
Di political fight for River state South South Nigeria don take a new dimension.
Now na di two factions of Lawmakers dey tackle dem sef dis na as di main rivals, di state govnor Sim Fubara and im oga Nyesom Wike no no dey too tok about di matter.
On Thursday di Federal High Court for Port Harcourt issue Form 48 against di Martin Amaewhule and im deputy Dumle Maol for contempt of court. Both man na members of a faction of di state Assembly.
Di issuance of Form 48 dey follow one application wey Ehie Edison – leader of anoda faction - of di Rivers State House of Assembly make say Amaewhule and Maol disobey di order of di Court on 9th November 2023.
Di court for suit number FHC/PH/CS/240/2023 bin order di parties say make dem no do anytin concerning di subject matter of di suit wey dey bifor di court.
But on Monday di Assembly under Amaewhule bin sit for di Assembly complex under alleged police coverage and deliberate on several issues.
Edison accuse Amaewhule say e invade di Rivers State House of Assembly and hold a sitting of di House in violation of di order of di court for parties to maintain status quo.
Sake of dis, di court enter Form 48 titled ‘Notice of Consequences of Disobedience of Order of Court’, dated November 22, 2023, and signed by di Registrar of di Federal High Court, Port Harcourt Judicial Division.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di notice wey dey issued for di case presided over by Justice Phoebe Ayua cut warning say di defendants go dey liable to be committed to prison unless dem obey di order of di Court and maintain di status quo.
Recall say Justice Ayua of di Federal High Court Port Harcourt issue order wey direct all parties to di Rivers Assembly crisis to maintain their status.
Transfer and counter-transfer of RSHA Staff
While dis dey go on, di clerk of di Rivers State House of Assembly Emeka Amadi and di deputy clerk Calistus Ojirika dey posted out of di Assembly.
Dis dey for one letter dated 20 November 2023 on Posting of senior officers wey di Director Service Welfare Inyingi Brown sign on behalf of di Rivers State Head of Service - "Di posting na wit immediate effect", di statement tok.
According to di letter, Emeka Amadi dey transferred to di Rivers State Scholarship Board, while Calistus Ojirika dey transferred to di Rivers State Small Town and Rural water Supply Agency.
But Amaewhule say make di public disregard di so-called posting or transfer of di Assembly staff.
For statement wey e sign, Amaewhule quote di position of di Rivers State House of Assembly Commission Law 1999 and di RSHA commission (Amendment) Law No. 10 of 2012 on di appointment and removal of di clerk and deputy clerk of di Assembly.
E say di head of service or even di Governor no get di powers to appoint, remove or transfer di Clerk or im Deputy once dem dey appointed.
"Di so-called posting of clerk and deputy clerk dey null and void. Dia appointment and removal na purely di job of di speaker and two-third majority of di House.
"Once appointed, dem go only dey removed by di provisions of di same Rivers State House of Assembly law wey prescribe disappointment. "
E come add say, "officers of goment wey undermine and attack di legislature go have a date wit di constitutionally empower di Assembly.”
Minister of Federal Capital Territory FCT Abuja, Nyesom Wike on Friday accuse di Rivers State govenor Siminialayi Fubara say e dey behind di burning of di State Assembly complex.
Wike tok dis one wen e dey tok with some tori pipo for im office for Abuja to address di political crises wey dey rock State wit di attempted impeachment of di govnor.
E say na im approve di Rivers State Ring road project wen im be govnor and tell Fubara to do di project as dat wan go guarantee im second term in office as govnor.
“If dem dey impeach you, you call me? Assuming now say na me dey plot am for example, you call me to say ah dem wan impeach me o!
“Na dat wan make you go send pipo to go burn di hallowed chambers? Impeachment dem dey do am one day? Impeachment na one day affair? Den you raise ethnic politics. We never get an like dis before,” E tok
Wike alllege say di Governor disobey di President, Vice President but emphasize say wen di law speak, thuggery go run, militants go run and ethnicity sef go run away but now di law neva tok.