List of kontris Ghana passport holder fit enta visa-free

pesin hold passport for hand

Wia dis foto come from, Getty Images

Afta South Africa and Ghana agree say passport holders of di kontries fit enter without visas, di tok about making movement easy for di continent don come up again.

Di latest waiver be for ordinary passport holders say dem go fit travel to and from both kontris without visas for 90 days each year.

For di agreement to start on 1 November dis year, travellers go transit through, depart from and stay for di territory of Ghana and South Africa for 90 days without recourse to work.”

But di rainbow kontri no be di only place pesin wit Ghana passport fit enter without visa.

For some kontries di passport holder fit enter without visa, for odas pesin fit get visa-on-arrival wia dem also get one system wey di traveller for get electronic travel authorization (eTA).

Di foreign affairs ministry for Ghana as of 10 May 2022 notify di immigration service about some kontries wia pipo wit ghana passports go fit travel without visas.

Some kontries Ghanaians fit enter without visa

  • Barbados
  • Burkina Faso
  • Mauritius
  • Nigeria
  • Seychelles
  • Benin
  • Kenya
  • Cape Verde
  • Lesotho
  • Ivory Coast
  • Tanzania
  • Senegal
  • Trinidad & Tobago
  • Liberia
  • Singapore
  • Niger
  • Uganda
  • Togo
  • Zimbabwe
  • Jamaica
  • Rwanda
  • Guyana
  • Saint Vincent & Grenadines

For di foreign ministry im letter wia dem write to di immigration service in May 2022, dem also list destinations wia pipo go fit go visa-free, but no be for all passport holders.

Kontries Ghanaians wit diplomatic & service passport fit enter visa-free

  • Brazil
  • Equatorial Guinea
  • China
  • Morocco
  • Cuba
  • Suriname
  • South Sudan
  • United Arab Emirates
  • Namibia
  • Venezuela
  • Hungary
  • Malta
  • India

Despite say dis kontries na visa-free entry, travellers for know say di duration of dia stay wit wetin dem wan do for there be subject to di visa regulations of each kontri.

For some oda kontries, Ghana passport holders go fit acquire dia visa as dem arrive for di kontri.

For most cases, di pesin fit get di visa for airport or border point as dem arrive.

However, di cost of di visa wit di duration of stay dey different from kontri to kontri.

Di henley passport index wia bi original, authoritative ranking for passport for di world don tok say di Ghana passport dey rank 80th for dia 2023 index.

For dia henley passport index, dem list some of di kontries wia Ghana passport holders go fit go wey dem get visa-on-arrival arrangements.

Some kontries wey dey provide visa-on-arrival for Ghana passport holders

  • Palau islands
  • Burundi
  • Samoa
  • Comoros Island
  • Tuvalu
  • Djibouti
  • Iran
  • Ethiopia
  • Jordan
  • Mauritania
  • Saint Lucia
  • Somalia
  • Cambodia
  • Zambia
  • Maldives
  • Bolivia
  • Nicaragua

For pipo wia wan enter at least Pakistan and Sri Lanka, dem for get wetin dem dey call electronic travel authorization (eTA).

Dis na digital travel document for eligible travelers wey be visa-exempt for a specific kontri.

Di pesin for get di eTA online before dem go begin travel.

Dis visa provisions for Ghana passport holders be subject to change wit time.

Some be 30, 60 or 90-day visa as di specific kontri and di Ghana goment don agree.

If di visa agreements or say di travel restrictions and entry requirements between Ghana and di kontri change, na so di visa regime too go change.