Police tok how dem arrest Bayelsa based alleged kidnapper

Man wey dem tie im hand behind im back siddon ontop chair

Wia dis foto come from, Getty Images

Police for Bayelsa south-south Nigeria on Monday parade some alleged kidnappers wey dem say dey terrosrise di state.

Di Bayelsa State Commissioner of Police Nebolisa Okolo as e parade some of di suspects tell tori pipo say dis arrests dey follow investigate of many cases of kidnapping, armed robbery and cultism by operatives of Operation Restore Peace. 

CP Okolo add say di gang dey responsible for over ten high profile kidnappings for di state over period of seven years.

E say dem don arrest many of di gang members for separate operations and di last one dem arrest for Abuja.

Tok-tok pesin for Bayelsa State Police Command, SP Asinim Butswat bin earlier confam to BBC Pidgin say dem arrest am on 15 September 2022 and e dey dia custody but dem go reveal more details about im arrest on Monday 26 September 2022.

One video wey don go viral show one man wey pipo say na im dem arrest as im kneel down dey beg wit handcuff as some pipo dey engage am.

Police tok how dem make di arrest

CP Okolo say on 8 December 2020, dem kidnap one 48 year old Oladele Olushola, wey be bank manager for im house for Opolo and release am 12 December 2020 after dem pay a ransom of Eighty (N80) Million Naira.

Also, dem kidnap one 41 years old Danjuma Omeje manager of one new generation Bank for Yenagoa from im house for Okaka, Yenagoa, on 30th July 2022, and release am on 14th July 2022 after dem collect ransom of 60 million naira. Thirty (N30) Million Naira cash and US Dollar equivalent of Thirty (N30) Million Naira.

E say Operatives of Operation Restore Peace through investigate arrest some suspects; one of dem na 37 years old native of Azuzuama Community, Southern Ijaw LGA, wey be di alleged leader of the kidnapping gang.

E allegedly dey operate im kidnapping camp at Sunikiri creek near Oluasiri for Nembe Local Goment Area with im second in command one wey run away.

Di Police recover a brand new Toyota Avalon wey im buy bought for im wife with di money im allegedly get from di ransom dem collected.

CP Okolo say di gang leader allegedly confess say on 30th June 2022, im and anoda suspect and odas wey din run away bin gbab Danjuma Omeje for di entrance of im house for Okaka, kidnap am and drive comot inside a Blue Toyota Corolla Car.

E say dem allegedly carry di kidnap victim to im camp for Sunikiri Oluasiri, and release am on 14th July 2022 after dem collect N60 million ransom.

Di suspect also allegedly confess to di kidnap of anoda banker and a lady wey dem kidnap on 26th December 2015, as well as di kidnap of oda Igbo business men.

CP Okolo add say one of di suspects, wey dem arrest for Abuja na native of Eruan Community in Boki LGA, Cross River State, na former cleaner with one new generation Bank, an e confess say e collect Ten (10) Thousand US Dollars from di ransom money dem collect from di kidnap of Danjuma Omeje.

Nigerians dey react

Reports wey say di suspect dey known to flash im wealth on social media don make di tori wan wey Nigerians dey interested in.

E don even make Nigerians and even some celebrities to chook mouth put.

Comedian Imeh Bishop Umoh wey pipo sabi as Okon post for Instagram say: "No clear proven source of income yet you dey comfortable to take, keep, enjoy monies and lavish gifts without any form of probe. Den you be enabler and accomplice and you suppose get equal treatement wit di actual culprit if not worse." E tok.

Meanwhile, popular musician Paul Okoye of former PSquare say: "Dem catch one big boy afta dem discover say e be kidnapper, but I wan ask oh afta I see am wit different ladies dey flaunt money, so none of dis ladies ever ask am dat question? Dem no wan know, just bring dem make dem chop." E tok.

Police say dem go tok more about who e be and how dem gbab am for dia briefin later on.