You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin science tok about masturbation or self-pleasure?
Sanja bin start to learn about masturbation 'relatively late' at di age of 25.
"For me, na how I dey take relieve tiredness. But element of pleasure also dey inside," Sanja, wey dey 35 years now, tell BBC.
Research show say dis sexual act of self-pleasure also get some benefits, e dey improve immunity, relieve premenstrual stress for women, and e dey also reduce di risk of prostate cancer.
"Nobody sabi your body pass you," na wetin Anthony Smith, former deputy director of di Australian Research Centre for Sex, Health and Society for Melbourne tok. "Even your greatest lover for di world no go fit understand your body pass you."
Dem tok say wen men and women stimulate dia genitals by diasef, e dey make dem feel beta and e fit improve dia sex life.
Wetin be masturbation or self-pleasure?
According to some experts, masturbation dey common and e no dey harmful to health. Many men and women dey do am even though dem get sexual relationship wit dia partner.
Most pipo no dey like to tok about am but almost evribody dey practice am.
E get one old joke wey say 80 percent of pipo dey masturbate and di oda 20 percent dey lie about am. Of course, even though no be real statistic, but for most pipo, self-pleasure dey normal and na part of life.
Masturbation na wen you use your sexual organs for self-pleasure.
Sexual health and psychology expert Tanja Jovanovic tell BBC say masturbation "dey play important role for sexual development. Na natural way to explore your body, experience pleasure and achieve orgasm."
Misconceptions wey relate to masturbation
Over time and for di environment, some parents bin don train dia children wit some kain tins wey include threats about masturbation.
Nicola, wey dey 46 years, say: "I bin dey 14 wen my mama bin enta my room without knocking. She shock and she tell me say wetin I bin dey do (masturbation) go make my spine dry up"
But Nicola mama 'threats' no get any effect and Nicola bin kontinu to explore her sexual needs.
"Di feeling dey veri nice," im tok. "I dey feel good afta I do am, e dey nice to be your own boss sometimes."
Masturbation get any benefit?
Research show say masturbation get many benefits for physical and mental health.
Research wey sabi pipo bin conduct for one clinic for di American city of Cleveland show say:
E dey reduces stress and anxiety.
E dey improve sleep.
E dey increase attention.
E dey improve pesin mood.
E fit decrease pain.
E dey improve sex life.
E dey help deal wit anxiety and depression.
You no go fit contract any rare sexually transmitted disease (STD) from masturbation. Experts recommend make pipo dey use clean sex toys for masturbation.
During orgasm, di body dey release specific hormones, including dopamine and oxytocin.
May “Masturbation month”
Dr. Jocelyn Elders na di former head of di U.S. Department of Health Services from 1993 to 1994. During Bill Clinton presidency, im bin work on sex education and sexual health.
During dis time, im bin advocate for di health of young pipo, especially African-American girls, im say as soon as dem reach puberty, make dem dey aware of dia sexual health and learn to use different types of contraceptives.
For di 1994 United Nations AIDS Conference, Dr. Elders bin tok about masturbation. "I tink say na something wey be part of human sexuality and make we teach our children about am," im tok.
Di govment dat time bin no like di speech and dem bin force am to resign.
Afta im resign, Good Vibrations, one company wey dey make sex toys wey dey also provide sex education, bin declare May as Masturbation Month.
She discuss di social taboos wey dey surround sex later for life, say, "your mama and papa dey do am too. Your mama and papa dia mama and papa dey do am too."
Sanja bin learn about masturbation from her boyfriend. She later kontinu wit di habit both in and out of sex. "E dey exciting to dey self-sufficient," she tok.
"Of course, no be say na replacement for love, affection, and traditional sexual relationships. Na just nice addition."
She neva try sex toys or vibrators yet, even though she know say many pipo like dem.
Dem believe say make pipo begin discuss sexual health and sex life openly and make barriers no dey.
Di regret factor wey pipo dey associate wit masturbation
Sanja believe say masturbation dey veri important for women but pipo no dey tok about am well-well. "I only tok am wit few of my friends," she tok. "Na taboo subject for girls."
Psychologist Tanja Jovanovic say before pesin get sexual pleasure from oda pipo, e dey important to dey free from self-pleasure, and dis way, you go fit give dem pleasure too.
According to ma, "If you no understand wetin your body want, how you go fit share pleasure wit anoda pesin? Na why masturbation and learning about am na one of di most important lesson for life."
Any connection dey between porn addiction and masturbation?
Psychotherapist Paula Hall na expert wey dey treat pipo wit sex and porn addiction.
She say to avoid masturbation no be long-term solution to treat pipo wit porn addiction.
"For some pipo, e dey help dem to stop for sometime so dat dem fit explore dia natural sexual potential. But for most pipo, wey dey single and wey no get partner, e dey hard for dem to avoid masturbation sometimes," e tell BBC.
Dem say how much you depend on an action fit tell us weda you dey addicted to dat tin. According to dem, if you no fit stop yourself from watching porn, your dependence on dis behavior dey make you addictive.
UK NHS don issue sex education leaflet for men wey tok say scientific evidence against masturbation no dey. E dey tell children say e no go harm dem and say e no go blind or degrade you.
Di NHS website explanation for some of di causes of premature ejaculation na sake of say young men sometimes dey condition dia minds to finish masturbation sharp-sharp so dat nobody go catch dem. Dis habit fit dey hard to break later and e fit lead to premature ejaculation.
Wia di term masturbation come from?
Di history of di term 'masturbation' no dey clear. Before, dem believe say di term bin come from di Latin words for hand and stain.
However, scientists of today believe say di term come from Greece becos di Greek word mean to get pleasure from di sexual organs.