Dolly Parton husband, Carl Dean, die at di age of 82

Dolly Parton wear white and shine-shine costume dey play guitar and sing on stage while she dey smile
    • Author, Samantha Granville
    • Role, BBC News
  • Read am in 3 mins

Carl Dean, di longtime husband of kontri music icon Dolly Parton, die on Monday at di age of 82.

Dean, wey bin dey really private throughout im nearly 60-year marriage to Parton, die for Nashville, Tennessee, according to one statement she bin post on social media.

"Carl and me bin spend many wonderful years togeda. Words no fit do justice to di love wey we share for ova 60 years. Thank you for your prayers and sympathy," di statement read.

Di "9-5" singer bin meet Dean outside one laundromat for di first day she arrive for Nashville as an 18-year-old aspiring singer.

Parton, 79, remember dia first meeting, she say, "I bin dey surprised and I bin dey happy say while im bin dey tok to me, im look my face (na rare thing for me). Im bin dey genuinely interested in finding out who I be and wetin I dey about."

Two years later, on May 30, 1966, di couple exchange vows for one private ceremony for Ringgold, Georgia.

Throughout dia marriage, Dean bin no show imself for public, im choose instead to focus on im asphalt-paving business for Nashville.

Though im largely stay out of di limelight, Dean still continue to influence Parton work, most notably na im inspire her classic hit "Jolene."

She tell US media for 2008 say dat song na about one bank teller wey develop crush on Dean.

"She bin get dis terrible crush on my husband," Parton tok. "And im just love to dey go back to di bank becos she give am so much attention. Na kinda of like joke between us—wen I bin say=, 'you dey spend a lot of time for bank. I no believe say we get dis kind of money.' So really na innocent song all around, but e sound like a bad one."

Parton and Dean relationship bin remain a mystery sotay rumours start to fly say im no exist - but Parton bin joke about am.

"A lot of pipo bin say Carl Dean no exist, dem say na just somebody I create to keep oda pipo off me," she tell Associated Press for 1984.

Parton and Dean no get children togeda.

Im dey survived by im siblings, Sandra and Donnie, Parton according to di statement