Nutrition: Health benefit of pineapple

    • Author, Abubakar Maccido
    • Role, Reporter
    • Reporting from, Kano
  • Read am in 3 mins

Pineapple na one sweet tropical fruit wey plenty pipo for di world love well well.

E sweet, e get small sharp sour taste, e dey very juicy and na why e dey perfect for hot weather. Pineapple also get plenty nutrients and special tins wey dey help your bodi.

From boosting your immune system, to helping your belle digest food well, and even reducing bodi pain and inflammation.

"Pineapple na real padi to your body defense system. Just one cup fit give you more dan 88% of di vitamin C wey your bodi need every day! Vitamin C dey help your body build collagen to keep your skin, bones and tissue strong" Dietitian Sa'adatu for Kano tell BBC News Pidgin.

Health benefit of pineapple

  • Boosting your immune system: E dey protect your bodi cells from damage, so if you chop pineapple often, your bodi go fit fight infection quick and you go recover fast wen you sick.
  • High in manganese: Dis fruit still get plenty manganese wey your bodi need to break down food, make bones strong, and make blood clot wen you get small cut. One cup of pineapple fit give you more dan half of di manganese wey you need for di whole day.
  • Dey help digestion: You don ever notice say your mouth dey tingle small wen you chop fresh pineapple? Na bicos of bromelain, one enzyme wey dey break protein. Na di same reason why pineapple dey make meat soft, for your bodi, bromelain dey help digest food better and make sure you fit absorb the nutrients inside am. So afta you chop heavy food, small pineapple fit help your belle rest well.
  • Dey fight inflammation and pain: Bromelain still dey help reduce swelling, pain, and muscle soreness, if you just finish hard exercise or you injure small, chop pineapple e go help your bodi recover faster. Some study even show say bromelain fit help pipo wey get joint pain like osteoarthritis. Vitamin C inside pineapple still help keep inflammation for low level.
  • Full wit antioxidants: Anytime your bodi dey break down food or you dey exposed to smoke or dirty air, e dey create small small molecules wey fit damage your bodi cells. Pineapple full wit antioxidants like flavonoids and phenolic acid wey dey fight these free radicals, protect your bodi from sickness wey fit come later. Some scientists still believe say bromelain fit help reduce cancer risk.

Watch out for allergy and sensitivity

Dietitient Sulaiman tok say sometimes, pesin fit feel small tingling or burning for mouth afta you chop pineapple but make persin no worry, na bromelain dey react wit im mouth protein. E no mean say you get allergy.

But if you see swelling, hives or e hard you to breathe, you fit get pineapple allergy especially if you get latex allergy befor.

Nutritional Profile (per 100g, raw)

  • Energy: 53 Kcal
  • Carbohydrate: 11.4g
  • Fiber: 1.8g
  • Protein: 0.4g
  • Fat: 0.2g
  • Calcium: 22mg
  • Magnesium: 13mg
  • Potassium: 223mg
  • Folate: 18µg
  • Vitamin C: 34mg
  • Cholesterol: 0mg
  • Saturated Fat: 0.06g
  • Monounsaturated Fat: 0.04g
  • Polyunsaturated Fat: 0.06g

Pineapple na real tropical powerhouse. E full wit nutrients wey dey help your bodi from head go toe. Whether you chop am fresh, blend am for juice, or use am cook your meal, sabi pipo say you dey do your body serious good.