Morocco defeat na my ‘worst match’ -Nigeria goalkeeper

Wia dis foto come from, Super Falcons
Nigeria women goalkeeper Chiamaka Nnadozie say dia semi- final defeat to Morocco for di Women African Cup of nations na her ‘worst match.’
Di host nation beat nine-woman Nigeria 5-4 on penalties afta di two teams bin play 1-1 draw.
Atlas Lionesses goalkeeper Khadija Er-Rmici save Ifeoma Onumonu penalty to give her team advantage.
Before Rosella Ayane score di winning kick in front a crowd of ova 45,000 for Rabat.
Di result mean say Nigeria fail to retain dia title for North Africa.
Nnadozie wey bin make plenty saves for di match tok say " Since I start to dey play football dis na di worst match I don play for my life."
Super Falcons keeper tok for press conference afta di match.
"Wen we come hear our plan na to qualify for di World Cup and we do am. We dey happy for dat." She add
End of Di one wey oda users dey read well well
Morocco go now play South Africa for di final on Saturday.
While Nigeria go play Zambia for Bronze or third place match on Friday.
How Nigerians react to semi-final Wafcon defeat
Di semi final defeat to Morocco end Nigeria title defence for di ogbonge competition.
Super Falcons bin dey target dia tenth title for Morocco.
Although no be di kain result wey most Nigerians bin dey hope for, dem sha hail di team for dia effort.
LERRY @_AsiwajuLerry say "Win or Lose, I dey proud of di fight Super Falcons put tonight. Go down to 9 women and only lose to penalties."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
While tme @Timmyyoursales1 say "I swear di Super Falcons na di best description of Davido single "Stand Strong"
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
And Daniel Huesu @huesu_daniel say "Great display by di Super Falcons. Dem fly so high even wit one wing. Super proud of you girls."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Meanwhile LesBruno @Charlesommy1 say I watch di match proud of our girls. Super falcons indeed. Our striker for put more power for her penalty kick.
How Morocco beat Nigeria to qualify for Wafcon 2022 final

Wia dis foto come from, @EnMaroc
Hosts of di 2022 Women’s Africa Cup of Nations, Morocco dig deep to beat nine-women defending champions Nigeria to qualify for dia first Final.
Di Atlas Lionesses of Morocco beat Super Falcons 5-4 on penalties afta dem play 1-1 for regulation time.
Uchenna Kanu score di first goal of di match for Nigeria for di 62nd minute before Morocco equalise four minutes later through Sanaa Mssoudy
Di match still enta 30 minutes extra -time but nobody score, until e enta penalties.
Di defeat see Morocco end Super Falcons wey be di defending Champions of di tournament end dia dream to win di title for di tenth time.
Tale of two red cards for Nigeria

Wia dis foto come from, Super Falcons
Nigeria Super Falcons collect two red cards for di highly tensed match.
Halimatu Ayinde red ard land for di 41st minute afta she tackle Rosella Annie of Morocco.
Rasheedat Ajibade bin see yellow for dangerous foul on Ayane but di referee later change am to Red afta VAR check for di 71st minute.
Di Super Falcons player stamp di heel of di forward wey end her match day.
E prove to be di game changer as di two sending off happun to two of Nigeria best players for di tournament.
Although di nine-times champions battle hard during extra-time and for even take di lead through Gift Monday shot wey hit bar.
Dia gallant effort end wen striker Onomonu see goalkeeper Er-Rmichi save her penalty during di shootout.












