'Alcohol consumption fit cause seven types of cancer'

    • Author, Brajesh Upadhyay
    • Role, BBC News, Washington DC
  • Read am in 5 mins

One America top doctor don issue risk warnings on alcoholic beverages following new research wey link di drinks to seven types of cancer.

Di advisory from US Surgeon General Vivek Murthy say di "majority of Americans no know of dis risk" wey don lead to about 100,000 cases of cancer and e don kill 20,000 pipo annually for US.

E go require one act from Congress to change di existing warning labels, wey neva change since 1988.

Oga Murthy don also call for reassessing di recommended limits for alcohol consumption and boosting education effort about alcoholic drinks and cancer.

Di Surgeon General, wey be di lead tok-tok pesin on matta about public health in di federal goment, say alcohol na di third most common preventable cause of cancer afta tobacco and obesity.

"Di direct link between alcohol consumption and cancer risk dey well-established in at least seven types of cancer ...regardless of di type of alcohol (e.g., beer, wine, and spirits) wey dem drink,"Oga Murthy tok for one statement.

Dis include di increased risk of cancer of di breast (in women), throat, liver, oesophagus, mouth, larynx and colon.

Di new report recommend make health care providers dey encourage alcohol screening and treatment referrals as effort to increase general awareness.

Di warning labels currently dey required to say women wey get belle make dem no drink alcohol due to birth defect risks. E also state say "consumption of alcoholic beverages fit affect your ability to drive car or operate machinery, and fit cause health problems".

Ova di last two decades, kontris don increasingly introduce warning labels to inform consumers about di health risks of alcohol.

Di World Health Organization Global Status Report on Alcohol and Health in 2018, say 47 kontris don mandate health and safety warnings on alcohol beverages, dis na increase from 31 kontris in 2014.

Ireland na di first country in di world to mandate health warning linking any level of alcohol consumption to cancer. From 2026, e go become legal requirement for all bottles of alcohol in di Republic of Ireland to carry di label.

Many countries don revise di recommended limits for consumption afta new studies point say no amount of alcohol dey safe to drink.

Di US recommend say make e no pass more dan two drinks per day for men and one for women, while di UK suggest say make e no pass more dan 14 "units" of alcohol - around six glasses of wine, or pints of beer - per week.

Share prices of US-listed alcoholic beverage companies - including Diageo, di world biggest spirits manufacturer - fall by up to 4% following di announcement.

South Korea also require cancer-specific warnings on alcohol.

In di US, only Congress fit amend di new warning labels wey Oga Murthy recommend, and e no dey clear say di incoming Trump administration go support di change.

Alcohol intake give you a high risk of developing cancerous tumour for body

Sabi pipo say seven high risk cancer wey alcohol fit cause na Mouth and throat.

Voice box (larynx).

Esophagus.

Colon and rectum.

Liver.

Breast (in women).

According to di Centers for Disease Control and Prevention, drinking alcohol go increase your risk of getting cancer.

Some studies show say if you drink three or more alcoholic drinks every day say e go increase di risk of stomach and pancreatic cancers. Drinking alcohol fit also increase prostate cancer risk.

All alcoholic drinks including red and white wine, beer, and liquor dey linked wit cancer. Wen you drink less alcohol e dey good for your health dan wen you drink more.

Wen alcohol break down inside di body, e dey pass harmful chemical into di body. E fit also affect our body chemical signals, increasing di chance wey cancer go develop.

How you fit cut down on alcohol consumption

According to di Centers for Disease Control and Prevention, cutting down on alcohol fit reduce your cancer risk. If you drink moderately and eat healthier e go fit help you control any body illness and live longer.

  • Check if di alcohol wey you dey drink now dey excessive and e dey harmful for your health.
  • Decide how many you go drink weekly and daily. For instance, you fit decide to only drink one cup every evening or drink one every week.
  • If certain pipo, places, or activities dey tempt you you to drink more alcohol dan you plan, you fit avoid dem or set limit wit dose places and pipo .
  • Remove alcohol from every corner of your home or places wia you dey spend a lot of time.