Woman dem jail wrongfully for 20 years get $1.3m compensation - lawyer react

Kathleen Folbigg dey wear purple shirt. She get short curly brown hair.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Kathleen Folbigg case na one of di Australia greatest miscarriages of justice
    • Author, Tiffanie Turnbull
    • Role, BBC News, Sydney
  • Read am in 3 mins

Kathleen Folbigg, wey dem bin brand as "Australia worst mother" get offer of A$2m (£975,580, $1.3m) in compensation for 20 years of wrongful imprisonment, afta dem consider am di victim of one of di greatest miscarriages of justice.

For 2003, court bin convict Ms Folbigg ova di deaths of her four babies, but dem free am for 2023 afta judicial review of her case reveal say her babies die of genetic condition.

Legal experts don estimate say di 58-year-old fit expect one of di highest compensation payouts for Australian history, likely upwards of $10m.

However, on Thursday, Ms Folbigg lawyer tok say govment only offer $2m, e describe am as "profoundly unfair and unjust".

"Di sum wey dem offer na moral affront – woefully inadequate and ethically indefensible," Rhanee Rego tok for one statement.

"Di system don fail Kathleen Folbigg once again."

Inside one statement, New South Wales Attorney General Michael Daley tok say di decision na based on "thorough and extensive" consideration of Ms Folbigg application for compensation.

"At Ms Folbigg request, di Attorney General and govment agree not to publicly discuss di details of di decision."

Ms Folbigg four children - Caleb, Patrick, Sarah, and Laura - die suddenly between 1989 and 1999, between di age 19 days and 18 months.

For 2003, dem sentence her to 40 years in jail for di murders of Sarah, Patrick and Laura, and di manslaughter of Caleb, later dem downgrade am to 30 years on appeal.

Ms Folbigg bin always maintain her innocence, and for 2023 one landmark inquiry into her case find out say her babies fit don die from natural causes becos of incredibly rare gene mutations.

Ms Rego tok say di payment wey dem offer to Ms Folbigg no fairly take into account di suffering she don endure.

"Wen dem release Lindy Chamberlain for 1994, she receive $1.7 million for three years in prison," she tok, referencing anoda mother wey dem falsely convict of murder afta one animal carry her daughter from campsite.

"Kathleen Folbigg spend two decades in prison, for her wrongful imprisonment, dem offer her $2 million."

After her release, forensic criminologist Xanthe Mallett tell Australian Broadcasting Corporation say she "no go dey surprised" if compensation dem go award go be upwards of A$10m.

Meanwhile, Professor Gary Edmond, from di University of NSW, tell Guardian Australia say Ms Folbigg compensation payout " fit be" di largest in di country history.

Oda local media report say she fit receive damages of up to A$20m.