You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Burkina Faso, Mali, Niger must to fulfil requirements bifor dem go fit comot - Ecowas
Di West African regiona join bodi, Ecowas, don tok say dem no go recognise as Burkina Faso, Mali and Niger take comot for di organization, until di three kontris fulfil di requirements.
Dis na one of di decisions for di extraordinary meeting of Ecowas Mediation and Security Council wey happun for Abuja on Thursday.
Burkina Faso, Mali and Niger bin announce for January 28 say dem dey comot for Ecowas immediately. Dem later send formal notifications to the organisation di following day.
For di meeting wey dem do on Thursday, President of di Ecowas commission, Omar Alieu Touray, tok say di decision by Burkina Faso, Mali and Nigeria to comot for di organisation dey hasty and dem no meet di conditions for withdrawal.
According to di Ecowas treaty, e get one-year period bifor di notice of exit take effect.
Touray also tok say di three kontris neva really reason di effect of dia decision on dia citizens.
However, di kontris wey dey comot still dey maintain say dia withdrawal from Ecowas na wit immediate effect. Dem tok say dem dey comot sake of di economic sanctions wey Ecowas bin impose on dem.
All three kontris dey currently under military rule sake of di coup d'etats.
End of Di one wey oda users dey read well well
Political expert, Prof Jibrin Ibrahim tell BBC say Ecowas suppose dey kiaful wit di way dem dey treat di three kontris wey don comot make di wahala no get out of hand.
Ibrahim tok say a situation wia wahala dey for five out of di 15 kontris for Ecowas no speak well of di organisation.
"Four Ecowas member states don comot for democracy, and di situation for Senegal now be say di constitution don dey suspended. If five out of 15 kontris dey involved for dis kain wahala, di organization fit collapse as a whole, and di security issue for di region go worse pass," Prof Jibrin Ibrahim tok.
"Ecowas must find way to discuss wit dem and find solution, no be to dey use force. As dem comot for di organisation na big problem for di entire West African region, becos dia strength go reduce. You no go fit use divison take repair wetin don already spoil."
Di five kontris wey Prof Ibrahim dey refer to na Burkina Faso, Mali, Niger, Guniea, wey dey under sanction from Ecowas sake of military takeover of goment for di kontri for September 2021, and Senegal wia di President, Macky Sall, recently tok say im don postpone di konttri presidential election indefinitely.
Guinea and Senegal, however, neva tok say dem dey comot for Ecowas.
Di organisation go also take decision on di situation wey dey go on for Senegal.