‘Dem bin wan hijack Kano Supreme Court judgement but Tinubu no gree’

Wia dis foto come from, Facebook/Abba Kabir Yusuf
Govnor of Kano state Abba Yusuf dey happy as Supreme Court confam am as di authentic govnor of Kano state.
Im wey tok to tori pipo afta court finish im appeal case say wit im victory democracy don come back on track for Nigeria.
"I dey happy wit wetin di pipo of Kano state do by voting us into power na somtin wey dem do transparently.
E say di judgment show to di world say wetin Kano pipo do during di 2023 election to vote for am dey transparent and according to di electoral act and di constitution.
“Make I use dis opportunity to most humble extend my respect and appreciation to our learned justices of di supreme Court, di govor tok.
"By di verdict of di Court we believe say democracy dey back on track for Nigeria, we believe say justice and fairness go kontinu to dey top for our court especially di apex court, di supreme court"
"Make I take dis opportunity to most humbly also thank di president, Bola Tinubu and im vice Kashim Shettima sake of dia neutrality as dem no involve for di hijacking of di mandate of di good pipo of di state despite pressure from all corners."
National Auditor of di New Nigeria Pipo Party (NNPP), Ladipo Johnson,also hail di judgement of di Supreme Court wey validate govnor Abba Kabir Yusuf, as victory for democracy and di rule of law.
End of Di one wey oda users dey read well well
Supreme Court wey siddon for Abuja, Nigeria capital confam Abba Yusuf as di govnor of Kano state.
Di Supreme court set aside di lower courts decisions wey sack di Kano state Govnor, Yusuf Abba from office.
Di tribunal bin set aside Govnor Abba Yusuf of di New Nigeria Peoples Party, NNPP victory afta dem declare 165,663 of im votes invalid.
Di tribunal bin say dem remove di votes from ballot papers we no dey stamped or signed.
But di supreme court order say make dem restore all di ballot papers from wia dem remove di appellant votes.
Court say di paper get di logo of Inec and coat of arm as prescribed by di provisions of di Electoral Act.
Court also tok say di issue of party membership - anoda ground on which di lower courts bin sack am - na internal affairs of di party.
Abba Yusuf bin appeal di mata but di Appeal Court uphold di tribunal decision and fault di lower court as dem no disqualify di govnor.
Appeal Court bin also declare Nasiru Gawuna of di All Progressives Congress, APC winner of di election.
Dis na afta di Court of Appeal for 17 November, 2023 bin sack di incumbent Govnor of Kano State, Abba Yusuf wey dem elect under di New Nigeria People's Party, NNPP from office sake of say im no be registered member of di party so im no go fit contest under political party wey im no be member.
NNPP wey bin no dey satisfied wit di judgement file a notice of appeal for di Supreme Court to challenge di November 17 judgement.
Di court of Appeal for dia judgement uphold di decision of di Election Petition Tribunal, wey sack Govnor Abba Yusuf and declare Nasiru Gawuna, of di All Progressives Congress, APC as di elected govnor of Kano State.

Wia dis foto come from, Nasiru Gawuna/Facebook/BBC
Wetin bin don happun so far?
Di court of Appeal bin give judgement wey remove Govnor Abba Yusuf from office, sake of say im no be registered member of di NNPP.
Nigeria election body, di Independent Electoral Commission, Inec, bin declare Yusuf, candidate of di NNPP winner and return am elected, afta dem say e poll 1,019,602 votes to defeat Gawuna of di APC wey score 890,705 votes.
APC and dia govnorship candidate Gawuna wey no dey satisfied wit Inec declaration bin challenge di victory of Govnor Yusuf for di state tribunal.
On September 20 2023, di election petition tribunal for di Kano State govnorship election for dia judgement tok say make Inec withdraw di certificate of return dem issue Govnor Yusuf and give same to di APC candidate Nasiru Gawuna.
Di three-man panel wey Justice Oluyemi Akintan-Osadebay lead tok say 165,663 votes from Oga Yusuf total votes dey invalid.
Dem also say di ballot papers no dey stamped or signed therefore dem dey invalid - so dem reduce di number of votes of di NNPP candidate by 165,663.
After dat, di mata move to di Court of Appeal wia dem give dia own judgement.
Di three-man panel wey Justice M.A Adumeh lead for di judgement on Friday 17 November say di NNPP govnor sake of say im name no dey for di party register, im no dey qualified to contest di election under a party wey im no be member.
Court also tok say dem no sponsor am properly.
'We don put security measures in place' - CP
Meanwhile, ahead of di judgement, di Kano state Police Command bin assure residents of dia safety.
For statement wey tok-tok pesin SP Abdullahi Haruna Kiyawa, release on 11 January, 2024, di Commissioner of Police Usaini Gumel say di Command don put security measures in place wey go allow pipo go about dia lawful businesses witout any fear ot threat.
Im add say di Command dey work wit oda security agencies for di state to make sure say katakata no dey before and afta di Supreme Court judgement.
“We don mobilize sufficient armed personnel to provide security at all flashpoints including political parties offices, di State Goment House, Inec Headquarters, Banks, commercial areas, mosques, churches, recreation centres and motor parks before, during and afta di judgement.
“I dey give 100 percent assurance to all law-abiding residents of di state to go about freely wit dia daily activities without threat to lives and property”, di Commissioner tok.
Im say armed security pipo go dey for all di identified strategic locations to make sure say dem embark on surveillance duties and provide physical security during and afta di Supreme Court Judgement.













