You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
23 die for Adamawa flood - How goment fit reduce di impact of flood for Nigeria?
- Author, Abubakar Maccido
- Role, Reporter
- Reporting from, Kano
- Read am in 7 mins
Recently Nigeria don experience flood for some parts of di kontri wey claim lives and properties.
Atleast 23 pipo don die for Adamawa State for Northern Nigeria and many odas wunjure afta heavy flood sweep several communities for Yola North and Yola South Local goment areas of di state.
Di heavy rain start bifor day break and kontinu reach Sunday morning, and e cause serious wahala for di affected areas.
Adamawa state govnor, Ahmadu Fintiri say di Sunday flood actually kill 23 pipo, and many odas still dey miss.
Di govnor wen e visit di temporary displacement camp wey dey Yelwa Primary School on Monday tok about di flood and oda tins.
As e meet wit di pipo wey di flood comot from dia houses, Govnor Fintiri show say e heart dey heavy, and e still assure dem say goment go provide relief materials make life no too hard for dem.
Di govnor blame di flooding on two tins, heavy rainfall and blocked water channels wey some residents use build illegal structures.
E tok say becos of dis kain illegal building, water no fit flow enter river well, and na wetin cause di disaster be dat.
"If we no fix di way water dey flow for our towns, we go kontinu to suffer dis kind flooding eviri year. Dis no be time to blame, na time to build better drains and protect lives" Govnor Fintiri tok.
Places like Shagari Low Cost, Sabon Pegi, and Modire Yolde Pate for Yola South LGA suffer worst from di rain wey cause flood wey destroy pipo property and displace families.
Tok tok persin for Adamawa police command Saluiman Guroji tell BBC News Pidgin say dem also recover some deadi body dem.
How eva Governor Ahmadu Umaru Fintiri dey defend wetin im goment do during di flood wahala.
E beg make pipo focus on helping each oda instead of blaming goment wen disaster happun.
For one statement wey e post for im Facebook page on Sunday, Governor Fintiri answer pipo wey dey criticize how di state handle di flood issue. E tokk say di goment no sit down dey look.
"We dey on ground, my Deputy Governor Prof Kaletapwa Farauta and oda pipo dey field bicos we believe in action" e add.
Di govnor also tok about di Chochi project wey don tey wey pipo dey tok say e go help stop flood for di state.
"As for di Chochi project wey dem abandon since well, history go judge. No be eviri legacy dey age well."
E send condolence to families wey lose loved ones and pray for people wey flood affect.
"My heart dey with di families wey lose person and all di victims wey this flood touch."
Recent flood incidents
MAY 2025 - Di recent disaster for Nigeria wey claim many lives and properties na for Mokwa local goment area wey dey for Niger state for northern Nigeria.
Reports from authorities for Nigeria tok say more than 200 die while dem still say ova 300 pipo don disappear during di flood wey happun for May 29.
Di flood displace over 3,000 pipo in addition di floods wash away houses and bridges for di state.
SEPTEMBER 2024 - While also last year Borno state for northern Eastern Nigeria experience one of di worst flood disaster for 30 years for di state.
Di Borno flood also kill more dan 100 pipo and displace ova million pipo from dia homes according to wetin authorities tok for Nigeria.
Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) recently don release one statement wey tok say floods go hit for some states for Nigeria say as raining season go soon reach im peak dis year.
However many experts and authorities tink say floods wey dey happun for Nigeria na sake climate change wey dey happun for world.
Di Niger state Emergency Management Agency (NSEMA) tok say di recent flood kasala wey happun for di state na sake of climate change and deforestation.
Na acting director general for NSEMA tok dis one for Channel TV wey e describe Mokwa flood as some wey dem neva experience before.
Hussaini tok say even though dem predict flood for some parts of Mokwa, pipo believe say Mokwa town dey safe, becos e no dey directly for front or back of any big dam or river.
"I wan tell you say na becos of climate change, wahala wey dey happun for weather, and how pipo dey cut trees anyhow, places wey neva see flood before, don dey flood now" Hussaini tok.
"Na why I gatz tok say di flood wey happun dis time, nobodi expect am and e no easy to predict."
"Dis time around, we only predict flood for some villages for Mokwa Local Goment area, especially dos wey dey near River Niger" e add.
How goment fit reduce flood kasala for Nigeria
One safety expert Dr. Yusuf Idris Garba wey dey for Department of Environmental Management, for Bayero University, Kano. Tell BBC News Pidgin say many tins wey dey cos flood for Nigeria na climate change, lack of dams maintenance and lack of drainages for di kontri.
"Majorly flooding for Nigeria wey bin dey happun na lack of drainages, lack of dam maintenance and ogbonge one na di climate change"
"basically rampant or inappropriate waste disposal wey we dey get for our cities dey lead to choke up of our drainages wey dey cause flooding"
Dr Garba add say lack of Environmental Impact Assessment (EIA) dey contribute di water to over flaw di dams wey suppose to hold di flooding.
"Like for di one wey happen for Maiduguri last year, I think some of di recommendation of di experts wey conduct di EIA in di construction of di dam and post-construction.
"most of di challenges, na that maintenance attitude wey dey part of di tins wey result into some of di problems we face for Borno."
E also tok on how unpredicted rain dey cos wahala for Nigeria sake of climate change.
"Environmentally due to di some changes wey we dey get, like climate change, because of that, our rainfall dey tend to be unpredictable sake of wetin we dey call climatic uncertainties.
"Sometimes you go see say we dey experience very high intense rainfall within very short period of time wey later go cause floods especially for dos areas wey no get plenty drainage"
Wetin be solution?
Dr Garba highlight some important tins both goment and pipo gatz do wey fit reduce di effect of floods for Nigeria.
"Goment gats to involve expert and consultants wey sabi EIA, wey dey go do dams maintenance for di kontri.
"Anoda tin be say pipo gats to stop dey dispose waste anyhow especially for drainages, wey go eventually cause blockage and floods" im tok.
E also tok say many pipo dey build houses for where suppose be water ways only.
"You go see many pipo dey build houses where suppose be water ways or drainages for water to dey pass. Which dey make di flood disaster hit pipo well-well whenever strong rain fall."
We don take measures dis year – River Basin Jigawa
In effort to tackle flood disaster for Nigeria, River Basin wey dey for North west of Nigeria tok say all measures dey in place wey go fit help stop flood disaster dis year.
Tok tok persin for River Basin Development Authority for Hadejia, Jigawa state, Salisu Baba Hamza tell BBC News Pidgin say dem don take necessary measures as dem take last year wey give dem positive result.
"Recently we don supervise all our dams wey dey under our River Basin region, to see if dem get any issue. Our managing director don order us to release di water wey dey in di dams.
"Befor raining season we dey always make sure our dams dey open 24/7 supply water to pipo wey dey farm, so dat wen rain season reach im peak we no go face any flood kasala" Hamza tok.
Di PRO also tok about how dem dey try to remove one grass wey dem dey call 'Typer grass' wey dey block water from passing.
Hamza add say "Our dams dey link to many rivers but di problem be say we get one grass wey we dey call Typer grass wey dey very strong, dis grass dey block water to pass, dis situation fit cause kasala.