You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Who be Olasijibomi Ogundele 'Sujimoto' wey EFCC declare wanted
Di Economic Financial Crimes Commission (EFCC) don declare di Chief Executive Officer (CEO) of Sujimoto Construction Limited Olasijibomi Ogundele wanted.
Di Nigeria corruption police declare di socialite and businessman wanted for one notice dem post on dia social media accounts on Friday, 5 September, on top accuse of "alleged case of diversion of funds and money laundering".
"Di public dey hereby notified say Olasijibomi Ogundele of Sujimoto Luxury Construction Limited, wey im photograph appear above, dey wanted by di Economic and Financial Crimes Commission inside one alleged case of diversion of funds and money laundering." Tok-tok pesin for di commission Dele Oyewale announce for di notice.
While di anti-corruption body no too torchlight wetin e dey accused say e do, Ogundele for one emotional video try to clear di air on di mata.
For di video wey BBC no fit verify, oga Ogundele say, "I no be tiff, I no be fugitive. I dey go EFCC office to clear my name".
E explain say all dis gbas gbos start on top business wey im company bin dey run wit one state goment for Southeastern Nigeria.
Oga Ogundele tok for middle of tears say, "Na contract between my company and di state goment. Dem ask me make I build some projects wey bin dey very interesting. I bin dey go di state evri week. "
Who be Sujimoto
Di founder and Chief Executive Officer of Sujimoto Luxury Construction, dey popular for high-end real estate developments for Lagos, Nigeria largest commercial state, particularly for Ikoyi and Banana Island.
Di company dey popular for Nigeria luxury property market, wit projects valued in billions of naira.
For October 2024, operatives of di Force Criminal Investigations Department (FCID) for Abuja, Nigeria capital arrest Oga Ogundele on top accuse of one alleged $325,000 fraud wey involve one client, Kabiru Garba Ibrahim.
Di FCID bin launch investigation into how Ogundele real estate firm, Sujimoto Construction Limited, allegedly receive $325,000 from one client for one real estate deal for November 2020 and no deliver di project.
Di investigation bin come afta one lawyer, Pelumi Olajengbesi send petition give di Deputy Inspector-General of Police in charge of criminal investigations.
Di petition allege say di real estate mogul collect di sum of $325,000 from one Kabiru Garba Ibrahim on 5 November 2020.
E accuse Ogundele say e "collect money under false pretence, fraudulent misrepresentation, and criminal breach of trust."
Di real estate mogul deny di accusation.
E blame di falling naira and economic downturn for di kontri as di reason for di delay in delivering on di deal and e say im and di client go settle di mata.
Who be Olasijibomi Ogundele
44-year-old Olasijibomi Ogundele na from Osun state, and im last known address na G 29, Banana Island, Ikoyi, Lagos State", di anti-corruption agency tok.
From im LinkedIn account, Oga Ogundele say e start im career for risk assessment for 2004, e later move up to lending in SMEs and set up Moto Finance for Paris wey later branch out in Accra, Dubai, Madrid and New York City.
E say im start in real estate career for France bifor e break into di Nigeria Real Estate industry.
E start di Sujimoto Construction for 2013, and e claim to don transact ova N45billion in real estate since e start im career.
Di business mogul describe im vision as 'simple' wey be to revolutionize di African luxury Real Estate industry wit Nigeria as a starting point.
For 2020, Sijibomi dey named for Nigeria Top 10 list of Real Estate Disruptors. For 2022, e dey inducted as Lagos State Governor ambassador. Di Guardian list am among di 60 leading real estate CEOs of 2022 for Nigeria.