TikTok restore service for US after Trump pledge

Read am in 8 mins

TikTok don restart service for im 170 million users wey dey US afta President-elect Donald Trump tok say e go issue executive order to give di app small time wen e enta office on Monday.

Di Chinese owned app stop to dey work for American users on Saturday evening afta law wey ban am sake of national security grounds come to effect.

Trump wey bin support di ban of di platform bifor, bin promise on Sunday to delay wen di law go come into action and allow more time so dem go make deal. TikTok come tok say dem dey in di process of "restoring service".

Later, di app start to work again and one popup message to dia millions of users wey thank Trump gan-gan. For statement, di company thank am say e "provide clarity and assurance" and say dem go work wit Trump for "long term solution wey go keep TikTok for di United States".

TikTok CEO Shou Chew dey expected to attend Trump inauguration on Monday.

Trump post for Truth Social on Sunday say, "I dey ask companies make dem no allow TikTok dey dark! I go issue executive order on Monday wey go extend di time bifor di law prohibition start, so we go fit make deal to protect our national security."

TikTok parent company, Bytedance bin ignore law wey require am to sell dia US operations to avoid ban. Di law bin dey upheld by Supreme Court on Friday and go into effect on Sunday.

E neva clear which legal authority wey Trump get to postpone law wey don alreadi start. But e dey expected say im goment no go enforce di ban if e sign executive order.

Dis na about turn from Trump former position as e bin back TkTok ban bifor. But don say e don get "warm spot" for di app as e say im videos don get billions of views for di platform for im presidential campaign.

President Joe Biden administration sef tok say dem no go enforce di law and go allow di process to play out for di Trump administration.

TikTok bin go offline for United States, hours bifor one new law wey ban di platform suppose begin.

One message bin appear on di app for US users wey say dem don begin observe di law wey ban TikTok, meaning "you no fit use TikTok for now".

"We dey fortunate say President Trump don show say im go work wit us on solution to return TikTok once im take office," di message tok.

Users bin report say both Apple and Google remove di app from dia US app stores and TikTok.com no dey show videos.

Dis dey come afta di social media platform bin warn say e go "go dark" on Sunday unless Biden administration wey dey leave office give assurance say dem no go enforce di law.

For one statement wey e bin release late on Friday, TikTok say e go dey forced to "go dark" for United States on Sunday unless di goment chook hand for di mata bifor di ban go begin.

E say di White House and di Department of Justice "fail to provide di necessary clear informate plus assurance to di service providers wey dey important to make sure say TikTok dey available".

Di statement add say unless goment immediately step in to assure di video app say dem no go punish am for violating di ban wey go soon happun, e go dey "forced to go dark on January 19".

TikTok statement follow one Supreme Court decision earlier on Friday wey maintain one law wey ban di app for US unless di China-based parent company, ByteDance, sell di platform.

After di ruling, TikTok chief executive, Shou Zi Chew, appeal to U.S. president-elect Donald Trump, as e tank am for im "commitment to work wit us to find a solution".

Reacting to dis, Trump tell tori pipo NBC News on Saturday say im go "most likely" give TikTok one 90-day pardon from di ban once im take office on Monday.

"Di 90-day extension na somtin wey dey most likely to happun, becos e dey appropriate," Trump tell NBC News.

"If I decide to do dat, I go fit announce am on Monday."

Di White House say e dey di hands of di incoming administration to take action.

"We see no reason for TikTok or oda companies to take actions in di next few days bifor Trump administration take office on Monday," press secretary Karine Jean-Pierre tok for one statement.

TikTok users bin see one message earlier on Saturday wey say di law go "force us to make our services temporarily unavailable. We dey work to restore our service for di U.S. as soon as possible."

Bifor, dem bin tink say di ban no go affect TikTok users wey already don download di app for dia fone.

But since app update no go dey available once di ban come to life, di app go eventually degrade and become unusable over time.

TikTok fresh statement on Friday, however suggest say e fit immediately become unavailable to all users as well as pipo wey wan download am if dem ban am.

Influencers and content creators bin post videos on di app dey tell dia followers bye bye as di ban dey near.

One creator, Nicole Bloomgarden, tell BBC say not to dey on TikTok go mean serious salary cut, while anoda, Erika Thompson, say di educational content on di platform go be di "biggest loss" for di community.

Some users bin don dey announce wia dia content go dey available to view next, including one Chinese video app, Red Note, wey dem bin no too dey use bifor for America until now.

US Supreme Court support ban law

For April last year, US law order ByteDance say e must to sell di US version of im platform to neutral party or else face ban.

Tiktok challenge di law, as e argue say dis law violate im free speech protections for im 170 million users for di kontri.

But di US Supreme Court uphold di law as e reject di argument. Dis one bin mean say dem go remove di US version of di app from app stores and web hosting services.

Both Democrat and Republican lawmakers bin vote to ban di video-sharing app last year, sake of concerns about im links to di Chinese goment.

TikTok don repeatedly tok say dem no dey share information wit Beijing.

Di law give TikTok owner, ByteDance, until 19 January to sell di US version of di platform to a neutral party to avoid outright ban.

ByteDance don vow say im no go sell TikTok.

Wetin Supreme Court judges tok

Di Supreme Court pass dia judgement and no follow divided opinions, say di law no violate US Constitution First Amendment protection against goment abridgment of free speech.

Di justices agree wit di lower court decision wey uphold di measure afta ByteDance challenge am.

"Doubt no dey say for more dan 170 million Americans, TikTok dey offer correct and expansive outlet for expression, means of engagement, and source of community," di Supreme Court tok.

"But Congress don determine say to sell am off dey necessary to address dia well-supported national security concerns wey link to TikTok data collection practices and relationship wit foreign adversary."

Afta di Supreme Court ruling, White House press secretary Karine Jean-Pierre for statement tok say, President Joe Biden position on TikTok don dey clear for months: "Make TikTok remain available to Americans, but simply under American ownership or oda ownership wey go address di national security concerns wey Congress identify as dem dey develop dis law."

Trump go still fit save di app?

Trump one time fit don reason to ban TikTok - but e repeatedly tok am during 2024 election say now im firmly dey against di law, and e try to delay am, but e fail.

Despite di court ruling, for one interview wit CNN, e insist say TikTok future dey im hand - even though e no tok wetin im decision on di future of di social media platform go be.

On social media, e tok say im next step fit take some time to work out.

"Di Supreme Court decision dey expected, and evri one gatz respect am," e write.

"I go make my decision on TikTok soon, but I must get time to review di situation."

Pipo go still fit use TikTok even if e dey banned?

If Trump no go fit unban TikTok, den wetin go happun?

Di most likely way di US go fit enforce di ban na to order app stores make dem make am unavailable for download for dat region.

But di DoJ don tok say di actual process of implementing di law - and making sure firms dey compliant – go be "a process wey play out over time".

If pipo no go fit use legitimate means to access TikTok through digital storefronts, e no go affect dose wey already get di app for dia fones.

But since di app most likely no go dey publicly available anymore, dem no go fit deliver new updates to users for US – and dat go make di app buggier and, eventually, unusable.

Not to mention say dem dey provide many updates to fix security holes in apps, so if TikTok stop to get updates, dat fit present hackers wit millions of devices to target.

Oda kontris wey don ban TikTok

Dem don already ban TikTok for India, wey be one of di app largest markets bifor dem ban am for June 2020.

Authorities for Iran, Nepal, Afghanistan and Somalia bin also place compulsory ban on di app.

UK goment and Parliament ban TikTok from staff work devices for 2023, also di European Commission.

BBC bin also advise staff to delete TikTok from corporate phones sake of security fears.