Wetin we know about di attack for Oko Community of Anambra State wey claim lives

Wia dis foto come from, Federal Polytechnic Oko/ Facebook
Authorities for Anambra, southeast Nigeria, don confam say unidentified gunmen do shooting wey kill pipo and injure some for Oko Community for di state on Thursday night.
Police tok-tok pesin for di state Tochukwu Ikenga for statement say di incident na cult clash and add say na two pipo die from di incident.
However, local reports say at least five pipo don die while some dey for hospital dey collect treatment.
Videos wey BBC News Pidgin sight show at least seven pipo on di ground wit wetin resemble gun shot injuries.
Di incident cause major kasala all over di community as plenti pipo scamper to safety.
One lecturer for di school wey speak to our reporter and wey no want make we mention im name, say di attackers kidnap two lecturers of Federal Polytechnic, Oko, wey dey within di community.
E also confam say one staff of di polytechnic dey for hospital dey receive treatment sake of gunshot injury.
Chijioke Ibeziako wey be di tok-tok pesin of Federal Polytechnic, Oko, tell BBC News Pidgin say di incident no happun inside di school, say na within di host community e happun.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We don confam say di pipo dem kidnap na lecturers, we dey sure of one. Di victims of di shootings no be students," na so e tok.
E say kidnapping issue na somtin wey don dey ravage evriwia across di kontri.
Similar cult-related incident happun for October 2024 for Nibo community wia ova ten pipo die from gunshot wounds.
Dis latest incident dey happun few months away from di state govnorship election wey go happun soon.
Oko community dey few kilometres away from di hometown of di sitting govnor Charles Soludo wey come from Isuofia community.
Dis incident dey happun as Nigerians still dey mourn di pipo wey lose dia lives for Benue State attack, wey bin lead President Bola Tinubu to set up committee to stop di killings.











