Police reveal details around arrest of suspects for robbery incident wey kill Arise TV presenter

Read am in 3 mins

Police tok say dem don arrest 12 suspects wey dem accuse say involve for di robbery wey lead to di death of Arise TV Presenter, Somtochukwu Christella Maduagwu, wey pipo sabi as Sommie.

Reports say di 29-year-old, young lady die afta she jump di third-floor of her Abuja apartment afta robbers invade her compound.

Di FCT police tok-tok pesin tok say dem arrest di suspects afta conducting investigations.

Di police command list out di names of di suspects and items dem recover from di suspects.

FCT police command tok say dem don recover weapons such as one fabricated ak-47 rifle, thirty-six rounds of 9mm live ammunition, one local pistol, one pump-action gun, two live cartridges, two sharp knive, one cutlass.

Dem also recover other items four mobile phones wey dem steal and nine torchlights wey dem bin use during di operation.

Police tok say dem arrest four suspects through di tracking of di phones wey dem bin steal at di robbery scene.

"Shortly afta di robbery incident, we arrest four (4) of di suspects and one oda pesin through di tracking of phones wey dem steal from di apartment during di robbery," di statement tok.

Dem add say di first suspect admit to driving di white Honda CR-V jeep from di apartment afta di operation and di four admit say dem receive ₦200,000 from di proceeds of di crime.

Police tok say dem arrest di remaining members of di team on Wednesday wen dem dey plan to go rob Maitama area for Abuja early mor-mor on Thursday.

"All suspects don confess to di crimes, investigation dey ongoing." Na so police tok.

On September 29, Sommie die afta one robbery incident for her residence for Katampe area of Abuja.

Reports say she die from complications from injuries she get wen she bin jump from di third-floor of her apartment.

Her family don announce her burial arrangement, e go hold on October 18 for Anambra state.

According to di family statement, Service of Songs go hold on Wednesday, October 15, 2025, for Corpus Christi Cathedral, Kaduna Street, Port Harcourt.

Her funeral service go take place on Saturday, October 18, 2025, for di Saint Theresa Catholic Church, Agulu, Anambra State.

Sommie Maduagwu, na UK-trained lawyer, journalist, and former beauty queen.

Arise News and oda well-meaning Nigerians bin don call on govment to investigate di mata.