Moment wey Pope Francis make first public appearance, wave to crowd for St Peter Square

Wetin we call dis Video, Watch: Pope Francis wave to crowd from wheelchair for first public appearance since e comot hospital
Moment wey Pope Francis make first public appearance, wave to crowd for St Peter Square

Pope Francis make a surprise appearance for St Peter Square in di Vatican following di discharge from hospital afta five weeks of treatment.

Di Pope bin briefly appear on stage for wheelchair, wit an oxygen tube under im nose.

"Hello to evriybody," e tok, as e wave to di crowd wey dey cheer am. "Happy Sunday to all of you, tank you veri much."

Di Pope na 88 years and dem discharge am from hospital for Rome on 23 March and e bin appear for im window den to offer a blessing.

Doctors tok say e go need at least two months of rest for im residence. On Friday, di Vatican tok say im health dey improve and e dey "in good spirits" as e kontinue im work activities.

Dem admit di Pope to hospital on 14 February for an infection wey result in double pneumonia.

One of im doctors say e get two critical episodes during im treatment wia im "life dey for danger".

As of Friday, di Pope don improve slightly in breathing, movement and speaking, di Vatican tok.

Recent blood tests also show a slight improvement for im lung infection.

Di Pope dey require less supplemental oxygen, but kontinue to receive am during di day. At night, e dey receive a high-flow of oxygen through im nose as e need am.

E bin suffer a number of health issues throughout im life, including part of one of im lungs wey dem remove at age 21 and dis make am more open to infections.

Pope Francis na from Argentina and e don be Pope for 12 years.