Brazil declare 3-day mourning for victims of plane crash

Wia dis foto come from, EPA
Dem don recover at least 21 bodies from di site of di plane wey crash for Brazilian state of São Paulo, wey kill everybody on board.
Teams bin work all through di night to find victims of di disaster afta one twin-engine turboprop wey Voepass airline dey operate crash for di town of Vinhedo.
Di number of casualties bin increase go 62 on Saturday.
Voepass earlier tok say di ATR 72-500 bin dey carry 57 passengers and four crew between Cascavel for di southern state of Paraná go Guarulhos airport for São Paulo city.
But dem later confam say e get anoda passenger on di flight wey dem no add.
Footage wey fly up and down on social media bin show as one plane dey come down vertically, and e dey roll as e dey fall down.
Di aircraft bin crash for one residential area, but nobody on gorund injure. Officials say na only one house for one local condominium complex bin damage.
Capt Maycon Cristo, one tok-tok pesin for di fire department wey dey help wit di recovery, tok say so far, dem don identify two pipo from di evidence wey dem recover from di scene.
E say di teams bin dey rely on some factors to help identify passengers.
These include documents and di position of bodies in relation to seating, plus mobile phones dem recover from some of di victims.
Capt Cristo say dem don move di casualties go one police morgue for São Paulo.
Lt Ramatuel Silvino wey dey São Paulo civil defence service say family members go stay for one hotel for di city.
Brazilian president declare three-day mourning
Brazilian President Luiz Inácio Lula da Silva don declare three-day of mourning afta one tragic plane crash for di São Paulo region.
Di president announce ontop im X page on Saturday say, di kontri go mourn di 61 pipo wey die on Friday.
"In memory of di 61 victims of di tragic accident in Vinhedo, we don declare three days of official mourning in di country," president Lula tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Getty Images
Evri one wey wey dey inside di Voepass flight wey crash for di Brazilian state of São Paulo die, according to local authorities for Valinhos, near di city of Vinhedo, wia di plane bin go down.
Dem say di plane bin carry 57 passengers and four crew members.
Di twin-engine turboprop plane bin dey fly from Cascavel for di southern state of Paraná go di main airport for São Paulo city wen e crash for di town of Vinhedo, Voepass airline tok.
Footage wey dey spread on social media how one plane dey descend vertically, and e roll as e fall.
Local authorities say di plane land ontop one residential building.
For di town of Vinhedo for São Paulo state, wia di plane crash, officials say only one home for di local condominium complex dey damaged.
None of di residents dey hurt, according to city officials for Valinhos.
Brazil GloboNews television network show fotos of one large area wey dey on fire and smoking wreckage for one area wey house plenty.
Police and fire services dey for di scene and dem don alert local hospitals.
According to tracking website Flightradar24, dem build di plane for 2010 and e leave Cascavel for 11:56 local time (14:56 GMT). Di last signal dem receive from di aircraft na about one hour and half later.
Di President of Brazil, Luiz Inácio Lula da Silva, bin hold one minute silence for one event wia e bin dey speak.
E post di news of di crash on social media: “Veri sad. All my solidarity to di families and friends of di victims.”
Seven firefighting teams dey involved for di emergency response.
Di Fire Department of São Paulo bin post on X: "Aircraft crash, 7 teams dey involved, so far only dis information."
Local authorities say di nearby town of Valinhos don send 20 emergency personnel to di plane crash site for di town of Vinhedo for São Paulo state.
"Twenty men bin dey mobilised, including three vehicles from di Valinhos Municipal Civil Guard and one vehicle from di civil defense," Valinhos City Hall tok for one statement.
Airplane manufacturer dey 'fully engaged' to support investigation
Di plane crash na Brazil worst since 2007, wen oneTAM Express plane crash and burst into flames for São Paulo's Congonhas airport, and kill 199 pipo.
For now, e neva dey clear wetin cause ATR 72-500 to crash.
Authorities say dem don retrieve di flight recorders
ATR, di French-Italian plane maker, say dem dey co-operate wit di investigation.
According to di tracking website Flightradar24, flight 2283 bin take off from Cascavel at 11:56 local time (14:56 GMT) on Friday and e dey due to arrive at 13:40.
Di last signal dem receive from di aircraft bin dey about 20 minutes before e dey scheduled to land.
Brazil civil aviation agency tok say di plane, wey dem build for 2010, dey "in good operating condition, wit valid registration and airworthiness certificates".
Di four crew members on board at di time of di accident all of dem dey duly licensed and dem get valid qualifications, e add.
Di Uopeccan Cancer Hospital for Cascavel tell BBC Brasil say two of dia trainee doctors bin dey among di passengers wey die.









