Supreme Court change am for man wey want make dem comot Tinubu from office

Read am in 4 mins

Di Supreme Court of Nigeria don vex for one Ambrose Albert Owuru wey file lawsuit and ask dem to comot President Bola Tinubu from office.

Justice Uwani Musa Aba-Aji read di ruling on Monday 16 December as di court deliver judgement on di mata wey Oga Owuru bin file.

Di judge no just strike out di petition wey e describe as "frivolous and vexatious", but e also fine di applicant 5 million naira and order di Supreme Court registry make dem no accept any oda originating summons from am again.

According to Justice Musa Aba-Aji, Owuru - wey bin run for President for 2019 under Hope Democratic Party - dey notorious for always instituting cases wey no get head, thereby "wasting di time of di court".

Di Court of Appeal bin don also fine Owuru 40 million naira on top di mata wey im bin bring against Tinubu and di Independent National Electoral Commission (Inec).

For dis particular mata wey di Supreme Court decide dis Monday, Oworu bin allege say Tinubu no dey qualified to hold office as Nigeria President, and also say di President take power illegally.

E say Tinubu bin forfeit $460,000 to di United States of America sake of one alleged drug case and dat na wetin disqualify am. E also claim say Tinubu na active agent of Central Intelligence Agency (CIA) of di US goment.

Owuru, surprisingly, ask di Supreme Court to declare am president and order im inauguration into office.

E claim say na im be di winner of di 2019 election but President Muhammadu Buhari usurp power from am for eight years.

Buhari also follow for di defendants for dis mata, alongside di Attorney General of di Federation, Inec and Tinubu.

In response, di counsel to President Tinubu, Bode Olanipekun (SAN) tell di court say Owuru bin don file plenti cases wey many courts don dismiss sake of say dem no get head.

Even dis mata bifor di Supreme Court, Olanipekun tok say im no even know how to start responding to am. E describe di several cases wey Owuru don file as unheard of and unbearable for di law profession

Also, anoda Senior Advocate of Nigeria, Taiwo Osipitan tell di court say dem go refer di applicant to di Nigerian Bar Association for disciplinary action.

Who be Ambrose Albert Owuru?

  • Oga Owuru describe imsef as a British-trained lawyer wey dem call to di Nigerian bar for 1984.
  • For im campaign materials during di 2019 presidential elections, e promise amongst oda tins to give 2 million naira investment funds to all families for Nigeria.
  • E claim dat time say 80 million Nigerians don endorse am to be president.
  • E be author also and di title of one of im book na - Game Changer: Afric Welfarism and Wealth Distribution.
  • For 2021, Owuru bin file a similar law suit wey ask di court to comot Buhari from office and inaugurate am as winner. E also ask court to stop Inec from holding any election for 2023 until im don finish im four-year tenure. Justice Inyang Ekwo of di Federal High Court later strike out di case.