Asuu begin first protest under Tinubu govment - why university lecturers dey para

Di Academic Staff Union of Universities (Asuu) don start dia one day protest across Federal goment universities for di kontri and oda universities wey be dia member.
Dis dey come as di university lecturers dey threaten to go on strike if govment fail to address di issues wey dey for ground.
According to di university lecturers, di protest wey dem dey do across campuses for Nigeria na sake of arrears wey govment neva pay plus di poor living conditions wey dem dey live in.
Dis na di first time Asuu dey protest since President Bola Tinubu enta office.
Local tori pipo Punch say one of di tins wey Asuu dey ask for na make Nigeria govment implement di recommendations of di Yayale Ahmed report wey dem bin submit for February to avoid anoda strike.
For one Press Conference wey some ogbonge pipo for Asuu bin hold on Monday, di southwest zonal coordinator for Asuu, Prof Abiodun Olaniran say di report capture all di issues wey dey cause kasala between di union and govment and e also represent dia mind afta plenti years of negotiations, yet govment neva implement am.
Punch quote am say, "Di true test of govment sincerity dey for how dem handle di Yayale Ahmed report," Olaniran tok. "Our members just dey frustrated wit delay tactics and dem no longer dey willing to dey dragged along endlessly. Implementing dis report na di surest way to restore confidence and industrial peace."
Olaniran add say some of dia concerns include di 2009 agreement between Nigeria govment and Asuu wey include sustainable funding of universities, victimisation of union members for some universities.
Odas na di outstanding 25–35 per cent salary awards, third-party deductions wey dem neva pay and over four years of promotion arrears wey govment neva pay too.
E neva finish o, oda tins wey dey make Asuu para na di IPPIS platform wey govment still dey use dey pay dem, wey di union don reject since. Di lecturers dey also para as dem say govment no dey pay dem dia earned academic allowances.
"Many of our members no fit provide education for dia wards and dem don dey borrow to meet dia needs," im tok.
"Poor funding, salaries wey dem neva pay, non-payment of promotion arrears, and failure to mainstream academic allowances wey we earn don make our problems worse wey don also contribute to brain drain."
For Abuja, di Asuu Zonal Coordinator, Prof. Al-Amin Abdullahi, bin say di union dey demand make govment implement di 2009 Agreement and di release of three and a half months salaries wey govment seize.
"Crisis dey wey dey affect universities for Nigeria, and no be just Asuu problem; na di whole kontri," Abdullahi tok.
For Uyo, di Calabar Zone of Asuu reject di Tertiary Institution Staff Loan Scheme wey govment recently launch as dem describe am as "insult to di sensibilities of tertiary workers and di height of mockery of di Nigerian university system."
Di Zonal Coordinator, Dr. Ikechukwu Igwenyi of Ebonyi State University, say govment dey use di scheme as distraction from dia failure to implement new salary structure and honour agreements.
Di 2009 agreement na one of di tins wey Asuu dey always tok about anytime dem wan go on strike.
For 2024 Asuu bin threaten strike sake of di 2009 agreement wey govment no gree implement.
For March 2022 Asuu bin extend strike by anoda eight weeks wey affect Nigeria students bifor govment do tok-tok wit dem.
Some fotos from di protest
















