Full list of 31-man Super Eagles squad for September World Cup Qualifiers

Wia dis foto come from, The Nigeria Football Federation/Facebook
Super Eagles head coach Eric Chelle don release 31-man provisional squad for September 2026 Fifa World Cup qualifying matches against Rwanda and South Africa.
Nigeria Football Federation on Friday 22 August make di list public via official Super Eagles X handle.
Na defender William Ekong go captain di squad wey include first-choice goalkeeper Stanley Nwabali, defenders Olaoluwa Aina and Calvin Bassey, midfielders Alex Iwobi and Wilfred Ndidi, and forwards Victor Osimhen, Ademola Lookman, and Simon Moses.
Promising talents wey dey di list include goalkeeper Ebenezer Harcourt; defenders Bright Osayi-Samuel and Bruno Onyemaechi; midfielders Raphael Onyedika, Frank Onyeka, and Fisayo Dele-Bashiru; and forwards Sadiq Umar and Nathan Tella.
"Fourth-placed Nigeria take on Rwanda for di Godswill Akpabio Stadium on Saturday, 6th September for Matchday 7 encounter, bifor dem fly to Bloemfontein to confront South Africa for potentially-explosive Matchday 8 encounter on Tuesday, 9th September," NFF tok..
Nigeria camp go open for Uyo on Monday 1st September, ahead of di two important matches.
Full provisional squad list
Goalkeepers: Stanley Nwabali, Amas Obasogie, Adeleye Adebayo, and Ebenezer Harcourt.
Defenders: William Ekong, Calvin Bassey, Ola Aina, Bright Osayi-Samuel, Bruno Onyemaechi, Igoh Ogbu, Chidozie Awaziem, Felix Agu, and Benjamin Fredericks.
Midfielders: Alex Iwobi, Frank Onyeka, Alhassan Yusuf, Wilfred Ndidi, Fisayo Dele-Bashiru, Raphael Onyedika, and Christantus Uche.
Forwards: Ademola Lookman, Samuel Chukwueze, Victor Osimhen, Moses Simon, Victor Boniface, Cyriel Dessers, Sadiq Umar, Nathan Tella, Tolu Arokodare, Terem Moffi, and Adams Akor.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Meanwhile, friends and family no fit hold dia tears as dem bury legendary ex-Nigerian goalkeeper Peter Rufai on Friday 22 August.
Na for Ikoyi Cemetery for Lagos, southwest Nigeria, dem bury Dodo Mayana as pipo dey call am.
Di legendary goalkeeper die on Thursday 3 July at di age of 61.
Rufai bin sick for some weeks, bifor e give up di ghost for one hospital for Lagos.
Super Eagles for dia post on social media hail di legendary goalkeeper say e go dey "forever in our hearts".










