You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Some of your favourite African stars wey go miss Afcon 2023 for Ivory Coast
Di 2023 African cup of nations go start on 13 January for Ivory Coast.
Plenti teams don dey do dia preparations, some dey play friendly games, odas dey train for West Africa kontris to adjust to di climate for dis side.
Already, some Premier League and championship clubs for England don dey fear say di absence of some of dia key players during di Afcon go affect dem.
For oda leagues for Europe, like di French league, at least fifty players go miss one month for di Afcon.
But wit di tournament days away, some ogbonge players go miss out completely from Africa biggest football competition.
Some of dem na your favorite players.
Arsenal star Thomas Partey go miss di tournament
Arsenal midfielder and Black Stars deputy captain Thomas Partey go miss for di Africa Cup of Nations for Ivory Coast.
Partey wey don go injury since October dey resume light training.
End of Di one wey oda users dey read well well
But im coach Mikel Arteta tok say di team doctors dey monitor im progress.
Di player wey get 47 caps and 13 goals for di Black Stars go be big miss for Ghana.
Team coach Chris Hughton know wetin di midfielder dey bring to di team.
“Dis na player wey don get substantial injury. Na so I dey tok wit am and di Arsenal medical staff, dem dey treat di injury wit caution,” di Ghana coach explain.
Im also tok say “dis be di biggest injury for di player im career, na wetin I fit do as coach be say I go support am for dis period.”
Di player don already miss plenti games for Arsenal since October.
Leicester City forward Issahaku Fatawu don opt out
Di Leicester city forward get 15 caps for di Black Stars.
For im championship club Leicester City, Fatawu don create more chances pass any player.
Im create 19 chances wit 2 goals and 7 assists for 21 games.
Na so many pipo tink say im go take dat form come Ghana wia im go shine for Afcon.
But di former Dreams FC player go miss di tournament.
One ogbonge sports sabi pesin explain say di footballer take di decision sake of some arrangement for im loan agreement from sporting CP to Leicester city.
Saddick Adams tok day “per di loan agreement, one clause require say make Fatawu meet threshold of matches wey go make am secure permanent stay for Leicester”.
Im add say “di Afcon go make di player miss some games dat be why im decide say im go opt out of di Afcon.”
PAOK left back Baba Rahman say im past injuries don dey haunt am
For one game between Ghana and Central African Republic for Kumasi on 8 September, di fans don boo am evritime im touch di ball.
Some football fans tok say im no be good material for di Black Stars anymore especially afta im performance for di 2022 world cup.
Afta Chris Hughton announce di squad, di 29-year old wey get 51 caps for Ghana tok for one statement say im decide say im no go go Afcon sake of im “wan recover fully from past injuries.”
“I don battle injuries and recovery times di last few years wey I see am say for di best interest of my career, I for only play wen I neva dey tink about recovery or pain,” di PAOK defender tok.
Baba tok for one interview for 2022 say im almost quit football afta series of injuries.
For im career im don do two anterior cruciate ligament (ACL) surgeries and meniscus operation.
Dis na wetin affect im game wey make im play wit caution.
On 3 January, di left back don play for PAOK against OFI Crete for di greek super league wey im score one goal wit one assist as dem win 4-0.
Wilfred Ndidi pull out sake of last minute injury
Ndidi don hurt for Leicester City for dia 2-0 win against Cardiff city on 29 December.
“Di player suffer di injury afta di Cardiff game na so we leave am out of our next match day squad,” Leicester coach Enzo Maresca tok.
Di Nigerian star don play 21 games for Leicester city dis season wit two goals and six assists from midfield.
Im be one of di key players for di championship side.
Di 27 year-old get 50 caps for Nigeria but im go miss di tournament.
Super Eagles fans go miss di defensive midfield champion for Ivory Coast.
Na so dem call Royal Antwerp midfielder Alhassan Yusuf make im come replace am for di squad.
Nottingham Forest striker Taiwo Awoniyi anoda big miss for Nigeria
Di Forest forward before im injury don score four goals for ten games including one goal in di 2-3 defeat to Manchester United for August.
Im boss Steve Cooper don tok say di 26-year old im injury don scata afta im play for Nigeria during one international break.
“Taiwo go dey out for months sake of groin surgery. E go take long but we go see am again dis season,” di coach tok.
Di Forest striker im last game for Nigeria be one World Cup qualifier wey bin end 1-1 for 16 November 2023.
Despite say im no get plenti caps for di Super Eagles, in di last one year, Taiwo don establish imsef as one of di reliable options for di kontri.
Galatasaray forward Wilfried Zaha no get call up
Wilfried Zaha of Ivory Coast and Galatasaray no go play for im national team for Afcon 2023.
Dis na surprise to many pipo as Zaha be one of di prominent players for di kontri.
Di former Crystal place forward don represent Ivory Coast 31 times wit 5 goals.
Zaha don play 13 times for Galatasaray wit five goals since im move to di club for 2023.
Some sabi pesin don tok say sake of say im miss di Afcon qualifiers togeda wit di first round of World Cup qualifiers dat be why di coach no call am.
Di speedster don feature for di Afcon for Cameroon for 2021.
But football fans no go see di skilful footwork of di 31-year old for di 2023 tournament wey im home kontri dey host.
But di player imself no get wahala wit di coach im decision.
For one post for Instagram, Zaha write “good luck to di guys wey dem select to represent di kontri.”
Brentford forward Bryan Mbuemo dey miss sake of injury
Di Brentford star be key man for di Premier League club.
Im play 15 games wit 7 goals and 3 assists for di club.
Na so Cameroon fans figure say im go carry dis fine form help di kontri for Ivory Coast.
But Mbuemo wey sustain ankle injury for Brentford dia game against Brighton go dey absent for 12 weeks.
Im coach Thomas Frank tok say di 24-year old go “dey out for weeks afta di ligament damage wey im undergo surgery.”
Mbuemo get 14 caps for Cameroon wit 3 goals.
Im score one of di three goals as Cameroon beat Burundi for dia final Afcon qualifier.
But now di Indomitable Lions go look elsewhere for goals.