You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Burna Boy go perform ahead of Uefa Champions League final for Turkey
Burna Boy go perform ahead of di Uefa Champions League final for Istanbul, Turkey.
Uefa make di announcement on 16 March and tok say di Grammy Award winner go bring im energy and signature soulful vibes to millions of fans ahead of di final wey go shele for Saturday, 10 June.
Burna Boy na ogbonge Nigerian star wey im hit songs include Last Last, Common Person, It’s Plenty, Ye, On The Low and many more.
According to Uefa, Burna Boy go headline di 2023 Uefa Champions League Final Kick Off Show for Atatürk Olympic Stadium for Istanbul wit oda artistes wey dem go announce soon.
Uefa tok say di UEFA Champions League Final Kick Off Show by Pepsi dey unite music, sport and culture through performance.
"Di UEFA Champions League Final Kick Off Show na significant part of our joint efforts wit Pepsi, providing incredible opportunity to reach new and younger audiences wit some of di biggest names and rising stars for music.
We dey excited to showcase a line-up of talented artists at dis season's final for Istanbul for wetin dey sure to be energetic and memorable performance,” Guy-Laurent Epstein tok. Epstein na UEFA marketing director.
Who be Burna Boy?
Burna Boy wey im real name na Damini Ebunoluwa Ogulu na ogbonge Nigerian artiste wey don achieve a lot for di entertainment industry and also win Grammy Award.
End of Di one wey oda users dey read well well
Afta im release Like to Party for 2012, Burna Boy music career begin boom and since den im neva stop to dey give hit afta hit.
Di artiste dey popular not only for Nigerian but across di world sake of im hit songs wey include Last Last, Common Person, It’s Plenty, Ye, On The Low, Bank On It, Alone and many more.
Dem born am for Port Harcourt, di Rivers State capital in di 90s and im manager na im mama identified as Bose Ogulu.
Burna Boy release im first album na L.I.F.E - Leaving an Impact for Eternity wey im release for 2013. Im don release four more album since wey include On a Spaceship, Outside, African Giant, Twice as Tall, and Love, Damini.
Im 2020 album Twice as Tall give am Grammy Award for di Best Global Music Album category for 2021.
For di 63rd Grammy Award acceptance speech, Burna Boy say im win na big win for im generation of Africans all ova di world.
E also tok say im win na lesson to every African say dem fit achieve anytin wey dem set dia mind to achieve.
Nigerian artistes and world football stage performance
Dis no be di first time Nigerian artiste go perform for world football stage.
On 23 November, hitmaker and award-winner Kizz Daniel bin perform during di Fifa Fan Festival for di Qatar 2022 World Cup.
Kizz Daniel perform wit live band and thrill many music lovers wit im performance.
Afta Kizz Daniel performance, anoda award-winning Nigerian artiste and hitmaker Davido bin make di kontri proud wen im perform for di 2022 Fifa World Cup final wey shele on Sunday, 22 December 2022.
Davido bin join di duo of Aisha and Trinidad Cardona to perform ‘Hayya Hayya’ (Better Together) at di World Cup final.
Na Davido first public performance since im lose im son Ifeanyi Adeleke wey die of drowning for September 2022.
Davido and di oda two artistes perform di FIFA theme song for Lusail Stadium, Qatar.