Wetin Man Utd need to stay for Champions League - full Group by Group permutations

Manchester United

Wia dis foto come from, Getty Images

Ten teams don qualify for di Champions League round of 16 stage.

Arsenal, Bayern Munich and Manchester City all finish top of dia groups and dem dey among di eight top seeds for di last 16 draw.

Dem go dey joined by by RB Leipzig, Bayern Munich, Inter Milan, Real Madrid, Real Sociedad, Atletico Madrid, Lazio, Borussia Dortmund and Barcelona and PSV Eindhoven for di knockout stage.

Manchester United hopes of qualifying for di knockout stages of Champions League no dey dia hand again as dem head into di final round of group matches.

Fellow Premier League side Newcastle United dey also rely on oda results to go dia way – di two English teams must win to get a chance of progressing.

Champions league Group A

Manchester United must beat Bayern Munich for Old Trafford on 12 December and hope say Copenhagen and Galatasaray match end for draw, to qualify for di last 16.

If United beat Bayern and winner dey for oda match for Group A, den Erik ten Hag side go finish for third place and drop to Europa League.

Bayern Munich reach di Champions League knockout stage as group winners wit two matches to spare afta dem beat Galatasaray.

Copenhagen go qualify if dem win Galatasaray or if dem draw and United fail to beat Bayern Munich.

Galatasaray must beat Copenhagen to qualify because of dia inferior goal difference and di fact say dem draw 2-2 for dia first meeting.

Champion League Group B

Arsenal qualify as Group B winners wit one game to spare.

PSV Eindhoven also don qualify as runners-up.

Sevilla and Lens already don comot. Lens go hold on to third spot and drop to Europa League if dem avoid defeat against Sevilla for dia final match.

Champions League Group C

Real Madrid reach di knockout stages for di 26th consecutive season wit victory ova Sporting Braga for dia previous round of games.

Napoli go confam dia spot for di last 16 if dem avoid defeat against Sporting Braga for di final game.

Union Berlin don already chop elimination.

Champions League Group D

Real Sociedad and Inter Milan don already reach di knockout stage.

Red Bull Salzburg go claim third spot if dem avoid defeat against Benfica for dia final match. Di winner of di match between Sociedad and Inter go decide who go top di group.

Champions League Group E

Celtic European hopes end wit one match to spare for Group E wen dem chop 2-0 beating away to Lazio.

Brendan Rodgers side bin need to win to keep any hope of progressing for di Champions League, or even di consolation of a Europa League spot.

Lazio and Atletico Madrid secure dia place for di last 16 on matchday five and dem go face each oda to decide who go top di group for di final round of fixtures on 13 December.

Feyenoord go drop to Europa League.

Champions league Group F

Newcastle United must beat AC Milan for St James' Park for dia final match for Group F to keep dia Champions League dreams and hope say Borussia Dortmund wey don already qualify to avoid defeat at home to Paris St-Germain.

AC Milan must beat Newcastle and hope PSG lose to reach di last 16.

Dat na because of dia inferior head-to-head record wit di French champions.

PSG fit overtake Dortmund and finish as group winners, and ensure say dem qualify no matter di result elsewhere, if dem beat di Bundesliga side on December 13.

Champions League Group G

Manchester City reach di last 16 wit two matches to spare by defeating Young Boys on 7 November.

Dat same evening, Group G rivals RB Leipzig join dem for di knockout stage, wit victory ova Red Star Belgrade.

City win di group wit one game to play wen dem beat Leipzig 3-2, while Young Boys secure dia spot for di Europa League wit a win against Red Star Belgrade.

Dat na because di Swiss champions gol finish di campaign wit a superior head-to-head record ova Red Star.

Champions League Group H

Barcelona reach di knockout stages for di first time for three years wen dem come from behind to beat Porto 2-1 on matchday five.

Porto and Shakhtar Donetsk go still play each oda, Barcelona ensure say dem go finish at least for second-placed position.

Dem go advance as group winners unless dem lose to Royal Antwerp for dia final fixture and Shakhtar, wey get better head-to-head record pass Barca, beat Porto.

Only a Shakhtar win ova Porto for Estadio do Dragao go mean say di Ukrainian champions advance to di last 16. Any oda result den di Portuguese club go progress.

Royal Antwerp don already comot for Champions League and Europa League .