Full Champions League 2023/24 draws

Champions League group draws

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Last year di draw bin take place for Istanbul but now e don return to Monaco

Manchester United go face Bayern Munich, while reigning champions Manchester City dey di same group as RB Leipzig for di 2023-24 Champions League.

While Newcastle United di oda English side for di competition go play Paris St-Germain, Borussia Dortmund and AC Milan dey di same group.

Di Magpies, dey di group stage for di first time since 2002-03, dem go face three European giants wey all at least don reach di final for di past 16 years.

Arsenal dey wit Sevilla and Celtic go play Atletico Madrid.

Di draws for di group stage of di 2022-23 Champions League bin take place on Thursday evening for Monaco.

Na 32 teams qualify for dis season competition.

Dis na di full list for di group stage draw:

Group A: Bayern Munich, Manchester United, Copenhagen, Galatasaray.

Group B: Sevilla, Arsenal, PSV, Lens.

Group C: Napoli, Real Madrid, Braga, Union Berlin.

Group D: Benfica, Inter Milan, Red Bull Salzburg, Real Sociedad.

Group E: Feyenoord, Atletico Madrid, Lazio, Celtic.

Group F: Paris Saint-Germain, Borussia Dortmund, AC Milan, Newcastle.

Group G: Manchester City, RB Leipzig, Red Star Belgrade, Young Boys.

Group H: Barcelona, Porto, Shakhtar Donetsk, Antwerp.

Di group stages go start from 19 September to 13 December, na Wembley go host di final for 1 June.

Na di last Champions League under di current format, wia di top two of each of di four-team group go qualify for di last-16 knockout phase.

From next season e go increase to 36 teams, from di 32, wey e dey now and all of dem go play eight matches, instead of six, against eight different opponents.

Four home games and four away.

Dem go rank all 36 sides for one league table.

Di top eight go qualify straight into di last 16, while di teams wey ranked ninth to 24th go face two-legged play-offs to join dem.

Erling Haaland win di Uefa men's player of di year

Di Manchester City forward don win two awards dis week.

E bin di PFA player of di year earlier for di week and now im don win this afta im ogbonge first season for England.

Di Norway striker end di season wit 52 goals in 53 games as City win di Treble.

Aitana Bonmati win di Uefa women's player of di year

Di Barcelona and Spain midfielder win di award sake of her performance for di season.

Pep Guardiola wins Uefa men's coach of di year

Di Manchester City win di award afta im winning di Champions League and di Treble last season.

Sarina Wiegman wins Uefa women's coach of di year

Di England women head coach win di award afta she guide her team reach di final of di Women's World Cup and win di Finalissima against Brazil for Wembley.

Champions League pots: Who dey di group stage?

Pot 1: MANCHESTER CITY, Sevilla, Barcelona, Napoli, Bayern Munich, Paris St-Germain, Benfica, Feyenoord

Pot 2: Real Madrid, MANCHESTER UNITED, Inter Milan, Borussia Dortmund, Atletico Madrid, RB Leipzig, Porto, ARSENAL

Pot 3: Shakhtar Donetsk, Salzburg, Milan, Braga, PSV Eindhoven, Lazio, Red Star Belgrade, FC Copenhagen

Pot 4: Young Boys, Real Sociedad, Galatasaray, CELTIC, NEWCASTLE UNITED, Union Berlin, Royal Antwerp, RC Lens