Who be Rami Tahini, Johnny Drille Wife?

Wia dis foto come from, Facebook/ Johnny Drille
Dis na ogbonge or not too ogbonge time for 'Drillers' as e clear say John Ighodaro alias Johnny Drille don marry.
Dis informate comot afta e release one brand new song called 'The Best Part'.
For video wey im use take promote di song, e post video for social wia im tok say Rima Tahini na best part of im life wey im neva share until now.
E tell am say, "You complete me, thank you for loving me".
Johnny Drille and Rima Tahini don dey married for ova one year now, according to tori for her social media.
Na Don Jazzy, di oga of Mavin Records wey Johnny Drille dey sing under reveal di tori afta e post pictures from di wedding on Tuesday.
Dis na sake of say Johnny Drille carry im fans catch cruise before, wit di release of im last song, Believe Me wey im claim to don marry di actress wey feature for di video, Tomi Ojo.
According to di muscian 4 July na Rima birthday wey fit give reason to why di song come out.
End of Di one wey oda users dey read well well
Rima Tahini na di Director in charge of A&R for Mavin Global.
According to tori wey dey come from im social media, dem don dey togeda for five years.
Who be Johnny Drille?

Wia dis foto come from, Facebook/ Johnny Drille
Johnny Drille na star wey burst enta di Nigeria music scene for 2015 afta di release of im banger, Wait for Me.
Before den, im bin feature for di sixth season of Project Fame for 2013 but e no win.
Following di release and hit of Wait For Me for 2015, Johnny Drille kontinu to release more hit songs wey include My Beautiful Love, Love Don't Lie and Start All Over wey feature Niniola.
By 2017, Mavins unveil di singer as part of dia signing for list wey include rapper, LadiPoe and singing twins DNA.
From dia e release im first studio album wey im call "Before We Fall Asleep", as well as di video for im first hit, Wait for Me.
E sing wit Teni, Simi and di legendary boyband Styl Plus wey feature for im first album and feature Phyno and Adekunle Gold for im EP, Home.
Johnny Drille don also work on plenti hit songs as producer as e follow work for Nonso Bassey and Cohbams.
Not much dey known about di star love life.
To be honest wetin dey ground na only wetin e don tok for public.
Apart from im wife, Rima, e don tok about one woman wey im bin get past connection wit wen e bin dey Edo state but e bin no run am.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dis na as di woman, Efe don feature for inside three hit songs wey im release, as im declare for 2019 say Finding Efe, go be di last song e go release about di babe.
Di songs also include Beautiful Love wia im end wit di line "Efe call me wen you hear dis song".
As di love singer wey im be, e also cause controversy wit di actress wey bin feature for di "Believe Me", Tomi Ojo as dem bin run fans street wit love posts wey dem bin dey write each oda on Twitter.
Who be Rima Tahini?

Wia dis foto come from, Instagram/@rimouuune
Rima Tahini na di Director of Artist and Repertoire for Mavin Global and dey also work as Senior Advisor for di investment company, Kupanda Capital.
According to di African Leadership Academy (ALA) wia she for graduate, Tahini bin dey born for Sierra Leone to Lebanese papa and Sierra Leonean mama.
She bin also get her Bachelors in Business for 2016 for Brandeis University for Massachusetts wia she graduate summa cum laude.
She don dey work wit Kupanda Capital since 2016, but na for August 2018, she start to dey work for Mavin.
And according to her LinkedIn profile she still dey work for di two joinbodi.
For March 2023, she bin speak for Harvard Business School as dem dey run di 25th anniversary of dia African Business summit.
She also become a member of Grammy Recording Academy for 2022.
Rima Tahini dey run Artiste residency fund for ALA wey go allow young artiste shadow Rima and contribute for Mavin.












