Tinubu withdraw appointment of di 24-year-old FERMA chairman

Imam Ibrahim Kashim Imam

Wia dis foto come from, Imam Ibrahim Kashim Imam

Wetin we call dis foto, Imam Ibrahim Kashim Imam

Nigeria President Bola Tinubu don do about turn and comot di nomination for appointment of Engineer Imam Ibrahim Kashim Imam less dan one week afta e bin appoint am.

For statement wey di special adviser on Media and Publicity release on Thursday, di withdrawal dey come wit immediate effect.

Ajuri Ngelale tok say dis withdrawal no go affect any of di oda Board and Executive Management team of Ferma.

“President Bola Tinubu don direct di withdrawal of di nomination of Engr. Imam Kashim Imam to serve as di Chairman of di Board of Directors of di Federal Roads Maintenance Agency (FERMA).

“Di President withdrawal of di above-mentioned nomination dey directed wit immediate effect,” Ngelale tok for di statement.

Di president no give reason for withdrawing di appointment of di fresh graduate Imam Ibrahim Kashim Imam.

Tinubu bin appoint one 24-year-old man to head di Federal Roads Maintenance Agency (FERMA) on Sunday and dis appointment don cause tok-tok on social media.

President Tinubu tok-tok pesin Ajuri Ngelale for im social media page on Friday tok say Engineer Imam Ibrahim Kashim Imam go lead FERMA govning board and management for renewable term of four years

Who be Imam Ibrahim Kashim Imam

Dem born Imam Ibrahim Kashim Imam for 27 December 1998.

Imam na first class graduate of Mechanical Engineering from Brighton University. E also get im master's degree in Engineering Management from di same university.

Imam finish im National Youth Service Corps (NYSC) programme for 2022 and na former special assistant to di current minister of works and ex-Ebonyi State govnor, Dave Umahi.

Im papa na Kashim Ibrahim-Imam wey be di current chairman of Tertiary Education Trust Fund (TETFUND).

For 2003 wey im papa run for Borno govnor under di Peoples Democratic Party (PDP), im lose to Ali Modu Sheriff of di All Nigeria Peoples Party (ANPP).

Imam papa also lose im govnorship bid to Sheriff for 2007 wen im constest under di same party.