'Di warning come five minutes before di strike' - Di Gaza neighbourhood wey don reduce to waste

Wia dis foto come from, Getty Images/Al Zahra Municipality
- Author, Adnan Elbursh
- Role, BBC World Service
- Reporting from, Gaza
Before you close eye open am, Al Zahra towers wey dey di heart of di Gaza Strip turn from residential district into big waste.
At least 25 residential towers na im Israel air strikes target for wetin bin be fairly calm and well-to-do Gaza neighbourhood.
One woman wey lost her home, Umm Salim al-Saafin, cry bitterly as she tell me say Israeli army bin order dem to evacuate dia home around 8:30pm on Thursday night (19 October).
Den, she say, dem bomb di area continuously from 9pm until 7am on Friday morning.


Wia dis foto come from, Getty images
For her building, she say, 20 flats bin dey dia, each na family bin dey live dia - none of dem get anywia wey dem fit go.
"We be civilians wey bin dey live peacefully for our house, why dem dey bomb us? Wetin we do?" anoda woman wey lose her house, Umm Mohammed, say.
Di target of Al Zahra towers don leave about 5,000 people homeless, adding to di hundreds of thousands of Gaza pipo wey already dey displaced.
"Dis na genocide," Abu Rami, one of di area pipo wey lose dia housem tok.
Im say some families no leave and dem dey buried inside di building wey collapse.
But e dey impossible to recover dia deadi bodi or even search for survivors becos ambulance and oda emergency team no fit enta di area plus lack of necessary equipment.
"Everytin wey we ever get don go," pipo wey bin dey live for di tower wey return to inspect di destruction of dia house plus search for any of dia remaining belongings for di collapse tell BBC.
Dem gada some clothes wrap am for bedsheets, and carry few pillows, mattress and blankets.

Wia dis foto come from, Al Zahra Municipality
But dem don stop to look for dia belonging.
As BBC team still dey di neighbourhood, one resident tell dem say im recieve call from di Israel army wey order pipo to leave - di army wan destroy di remaining towers.
Dis make pipo to leave di area immediately.
BBC ask IDF for comment on wetin exactly dem bin target for Al Zahra.
Dem say dem dey "respond forcefully to dismantle Hamas military and administrative capabilities" in response to im "barbaric attacks".
"In stark contrast to Hamas intentional attacks on Israeli men, women and children, IDF follow international law and take possible precautions to prevent civilian harm".

Wia dis foto come from, Getty Images
Di town of Al Zahra, wia di towers bin dey, dem bin build am on empty land for late 1990s.
Former Palestine President Yasser Arafat order di construction to prevent di expansion of wetim dem call Nitzarim settlement, wey dey adjacent to di town from di north.
Di town streets and buildings and streets bin dey somehow modern, wit about 60 residential towers wey be home to up to ten thousand residents.
Di na home to public institutions, universities, and schools bifor.

Wia dis foto come from, Getty images
Hamza, one resident of Al Zahra, tell us di city bin dey far from di recent military operations and dem bin no ever target am before for previous wars.
Dis sense say na safe place make am location for pipo wey lose dia homes for oda areas to go find safety.
Wen di war begin, Al-Zahra residents opendia house for dia relatives, wit each flat accommodating two or more families.
Wen dem destry di tower, residents plus dia guests no get any shelter again.
Even pipo wey dem no target dia house, no fit return dia sake of fear say dem fit bomb am any moment.
Hamza, wey dey stay wit im relatives describe di situation as "humanitarian catastrophe".
"Di warning dey come five minutes before di strike," im tell us.









