Dem go soon announce final election results for Liberia

Wia dis foto come from, Reuters
Dem go soon announce di final election results for Liberia afta di election body say dem don complete di nationwide ballot tallying and collation.
Voting bin happun again last week for two polling stations for north-eastern Nimba county.
Dis na afta some unknown pipo tamper wit di ballot during di first round of di elections on 10 October.
Di total poll outcome for presidential, senatorial and local representatives vote go dey announced for di National Elections Commission (NEC) headquarters in di capital, Monrovia, di agency chief, Davidetta Browne-Lansanah, tok.
Provisional results show say President George Weah and im main rival Joseph Boakai still dey run neck and neck, meaning say dem don set for a run-off.
Oga Weah get 43.8% of di vote while oga Boakai get 43.5%, according to provisional results dem announce last week.
A candidate need more dan 50% of di vote to be declared di winner.
Di election commission get until 25 October to release final results.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis na Liberia closest presidential race since di civil war wey end two decades ago.
Di run-off go hold on 7 November afta di announcement of official results.
Already, Liberia main opposition candidate Joseph Boakai don dey rally around smaller parties for dia support ahead of one likely run-off against incumbent George Weah.

Wia dis foto come from, EPA
Oga Weah, a former international football star, dey seek second term for office.
For one press conference, Boakai beg fellow opposition candidates to join di "rescue team for a resounding victory".
"We dey reach out to our brothers and sisters for di opposition and Liberians in general to join us for dis ogbonge mission of making our kontri breathe freely again," e add.
Oga Boakai promise say if im dey elected as president, im go form a "government of inclusion wey go truly reflect di political, social and religious diversity of di citizens".
None of di 18 oda candidates don receive more dan 3% of di vote.
For one statement last week, one of di smaller candidates, Alexander Cummings, no tok if im go support oga Boakai inside likely run-off but tok say "Liberian pipo want change".
For di 2017 run-off, oga Weah beat oga Boakai by 61.5% to 38.5% of di vote.
Di president bin get di most votes for di first round of dat election - 38.4% to Boakai 28.8%, wey suggest say oga Boakai try well-well for last week poll.
President Weah never comment on di provisional results but im ruling Coalition for Democratic Change don earlier pledge to accept di final results.

Wia dis foto come from, Reuters
Analyst Abdullah Kiatamba tell AFP news agency say whoever come out top for di first round go get di advantage of greater momentum.
Analysts say dis fit be di last attempt at di presidency for Mr Boakai, wey be 78-year-old.
E bin serve as vice-president for di goment of den-President Ellen Johnson Sirleaf, wey win di Nobel Peace Prize for her efforts to achieve peace and stability for Liberia afta one brutal civil war wey kill about 250,000 pipo.
E wage im campaign under di slogan "Rescue", on di argument say West African state don go down during Mr Weah first six years in office.
President Weah wey be 57-year-old don dismiss Oga Boakai allegations, e tok say im don make ogbonge steps, wey include introducing free tuition for university students.












