You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Portable leave prison afta court arraign am ontop accusation of assault
Nigerian singer Habeeb Okikiola alias Portable don leave prison afta e meet im bail conditions.
Portable comot from di Nigeria Correctional Service facility for Ilaro, Ogun State South West Nigeria on Monday evening.
Im Lawyer, agent and some followers accompany am comot from di prison.
Video show as di singer dey thank im fans for di support dem give am during di arraignment.
Police bin sama Portable wit charges wey border on assault and obstruction of justice.
Why police arrest Portable
Di Ogun State High Court wey dey sit for Ifo bin grant bail to di Nigerian singer.
Court grant di 28 year-old musician bail afta e plead not guilty to allegations of multiple assault wey police sama am.
Di count grant am bail to di tune of 300,000 naira and two sureties in like sum.
End of Di one wey oda users dey read well well
For charge wey get counts of conspiracy and assault, di court grant am bail in di sum of 500,000 naira wit sureties in like sum.
Also, one of di sureties gatz be a relative – both of dem must get landed property within wia di court dey.
Afta three days for police cell, singer Portable appear for court on Monday.
Di singer spend im weekend for police detention over di weekend afta e bin submit himself to di authorities on Friday.
Koko be say di Zazu coroner bin resist arrest and pour insult on police officers wey come to arrest am last week. Im do live video wey show am dey shout on police officers.
Ogun state police command tell tori pipo say pesin bin write petition against di singer and dem invite am to answer for imsef but e no honor di police invitation plenti times.
Dis make police send officers to go pick am up but e no gree follow dem.
Afta di incident, police tok-tok pesin Abimbola Oyeyemi release statement say dem dey give di singer till Friday last week to submit imsef to police or face arrest.
On Friday video go viral on social media wey show Portable dey arrive police station in company of im papa. Na dia e spend im weekend.
Di Court adjourn di matter till April 26 for commencement of trial.
One live video begin trend for social media wia di Zazu singer dey try resist arrest afta authority show for im bar for Ifo area of Ogun state Southwest Nigeria.
For di video, di Zazu singer bin make some comment like say police no fit arrest am sake of im be federal goment liability.
Police tok-tok pesin for Ogun state Abimbola Oyeyemi explain give BBC Pidgin say dem don serve di popular singer invitation more dan five times and e no gree honour am.
Who be Portable?
Im real name na Habeeb Okikiola, im be rapper, singer and songwriter.
Di self-proclaimed Son of Shaku Shaku, don climb di ranks of di kontri fastest-rising singers.
Portable an 28 years old musician wey come from Ogun State, South West of Nigeria.
For one video wey im share for im tiktok page, e tok say na Nigeria rap star, Olamide bring am to limelight.
Dem bin also share video of wia im meet wit di Nigeria rap star.
Portable Omolalomi social media following don increase well-well since e release di new single.
Currently, im get plenti followers on Instagram.