Donald Trump say im no dey guilty for Georgia election fraud case

Wia dis foto come from, Getty Images
Former United States President, Donald Trump say im no dey guilty for Georgia election fraud case, plus ignore im right to appear for court next week.
Trump follow among di 19 pipo wey dey charged wit conspiracy to change US state 2020 election results.
Im surrender imsef for Fulton County Prison for Atlanta last week, wia dem take im mugshot.
Trump don deny many time say im no do anytin, say na im political enemies dey ginger di case. For one court document wey dem file on Thursday, di former US president say im "fully understand" di kain office wey dey accuse am and im right to show for court.
"Understanding my rights, I hereby freely and voluntarily dismiss my right to dey present for court on di case and my right for dem to read am to me for open court," di document wey im sign tok.
Trump, wey be di current main politician for di 2024 Republican presidential nomination, bin don show for court for di three cases wey bin dey against am.
Di court bin require for am to show for di cases wey im bin dey face for New York and Florida, and im decide say im no wan appear online for one oda case for Washington DC.
For all di three cases, security tight as Trump supporters and counter-protesters gada near di court houses.
End of Di one wey oda users dey read well well
Georgia Fulton County na di only jurisdiction wia im dey face charges wia defendants fit no show for court wen dem charge dem wit criminal cases.
Brian Tevis, one Atlanta lawyer wey reperesent one of di pipo wey dem accuse wit Trump, Rudy Giuliani, tell CBS, wey be BBC US partner say, "99% of di time" defendants wey dem give oprion dey choose not to show for court.
Earlier dis week, three oda co-defendants for di case say dem too no guilty, including former Trump lawyers Ray Stallings Smith and Sidney Powell, plus former celebrity publicist Trevian Kutti.
Trump bin suppose show for court on 6 September, followed by di oda defendants wit 15, 15 minutes between dem.
All 19 defendants for di case – including oga Trump – dem charge dem wit violating Georgia Racketeer Influenced and Corrupt Organisations Act,wey dem dey also call Rico act.
Across US and di federal level, dem dey use Rico laws help goment lawyers connect juniors wey break di law wit di pipo wey give dem di orders or organised di crime.










