You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we sabi about di central Johannesburg block fire wey kill at least 73 pipo
Death toll don rise to over 70 for one fire outbreak wey happun inside a block of flats for Johannesburg, South African authorities tok.
Johannesburg Emergency Management Services toktok pesin Robert Mulaudzi say dem don find 73 bodies so far.
At least anoda 52 pipo dey injured and many dey reported to get back injuries, possibly from jumping from di windows.
Officials say e dey unclear wetin sparke di blaze or di five-storey building for di city centre.
Search and recovery operations dey continue.
One spokesman for di emergency services, Robert Mulaudzi, tell di BBC say firefighter don try bring out some of di occupants.
E say di fire bin catch di building, and say dem still dey continue di search for other victims.
"We dey move floor by floor conducting dis body recoveries," Oga Mulaudzi tell local broadcaster ENCA.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Mulaudzi say di building don dey abandoned previously, but homeless pipo come move in looking for shelter during di current cold winter months.
One video wey Oga Mulaudzi post for di platform X, formerly known as Twitter, showe fire trucks and ambulances outside di building wit burnt out windows.
Photos from di scene show as dem line up covered bodies near di burned building.
Reports suggest say occupants of di building be mostly migrants from other African kontri.
Local reports say di area wia di building dey located na inner city neighbourhood wey dey infamous for 'hijacked' buildings, a term wey dem normally use for South Africa to refer to buildings illegally taken over by undocumented immigrants.
In di wake of di fire, many South Africans on social media don condemn di online xenophobic attacks wey some don make against di victims and survivors of di fire.
One of di worst fires for Johannesburg's history
Dem don describe am as one of di worst fire incidents for Johannesburg in recent history - and fears dey say di number of fatalities go continue to rise as rescue workers enta di remaining floors of di five-storey building.
Na old building wey dem bin declare unsafe for use - but don dey taken over by property gangs operating for di city centre wey rent out rooms to scores of pipo per room.
Such buildings dey often without running water and pose fire hazard sake of di numerous illegal electricity connections tenants need to provide power.
Describing di incident, Johannesburg Emergency Services spokesman Robert Mulaudzi tell local media: "I neva see anything like dis for my 22 years or service for dis city.”
Officials say each floor resemble an informal settlement... rescue workers dey comb through partitions resembling shacks, searching for survivors - and more fatalities.
Some of those wey escaped don camp outside di building waiting for news of dia relatives, odas dey wait to see wetin dem fit safe from dia belongings.