Pikin wey dem save from im mama womb for Gaza don die

One pikin wey dem bin rescue from im dying mama womb afta one Israel airstrike for south of Gaza don die, BBC learn.

Dem deliver baby Sabreen al-Sakani through Caesarean section for one Rafah hospital just afta midnight on Sunday.

Inside all di katakata dat night, doctors bin revive di pikin, using one hand pump to push air inside her lungs.

But she die on Thursday and dem don bury her next to her mother wey dem bin name her afta.

Baby Sabreen bin dey among di 16 children wey dem kill for two air strike for Rafah last weekend. All of dem die for one bombing wey bin target di housing complex wia dem bin live.

Israel Defense Forces (IDF) say dem bin dey target Hamas fighters and infrastructure.

Sabreen mama bin dey seven-and-a-half months pregnant wen di Israeli bombing on di al-Sakani family home happun just bifor midnight on Saturday as she, her husband Shukri and dia three-year-old daughter Malak bin dey sleep.

Sabreen suffer very serious injuries and her husband and Malak die, but di baby bin still dey alive for inside her mama belle wen rescue workers reach di site.

Dem rush Sabreen go hospital, wia doctors perform emergency Caesarean section to deliver di pikin.

E bin be like Sabreen stabilise and dem put her for incubator. At dat time doctors bin say her condition dey critical.

She bin weigh just 1.4kg (3.1 lbs) wen dem born her and she bin get serious breathing problem, wey doctors say na sake of dem born her premature.

"Dis pikin suppose still dey im mama belle at dis time, but dem deny her dis right," Dr Mohammed Salama, head of emergency neo-natal unit for Emirati Hospital for Rafah, tok afta dem born her.

Baby Sabreen maternal grandmother, Mirvat al-Sakani, bin tell BBC say di family bin plan to adopt di pikin.

Di Hamas-run health ministry for Gaza say out of di more dan 34,000 pipo wey Israel bombing don kill for Gaza sine di war begin on 7 October, at least two-thirds na women and children.

Israel launch im attack afta about 1,200 Israelis and foreigners - mostly civilians – die and dem kidnap anoda 253 back to Gaza as hostages, according to Israeli calculation.

Now, about 1.4 million pipo dey crowded like sardine inside Rafah afta IDF tell dem to move south to safety earlier for di war.

However Israel says e dey plan ground offensive enta Rafah, as di Israeli PM Benjamin Netanyahu dey insist say e dey necessary to defeat Hamas and search for hostages.

Satellite images show two new tent camps for southern Gaza wit Israeli media reporting say plans dey ground to move civilians from Rafah.

US don beg Israel to use target approach instead of launching full-scale invasion of Rafah, wey fit cause even greater humanitarian crisis.