Wetin to know about Tanzania election protests

Read am in 4 mins

Protests don escalate for major cities across Tanzania as opposition supporters reject di 29 October presidential and parliamentary elections.

Di protests dey expected to continue dis Friday as demonstrators wan march go govment buildings ahead of di announcement of di election results dis weekend.

Local media report say di whereabouts of Tanzanian President Samia Suluhu Hassan and some senior officials dey unknown, BBC neva fit confam am.

Hundreds of demonstrators don also cross enta Kenyan territory, dem block roads, light bonfires and tear posters of President Samia Suluhu Hassan wey dey along di way.

Kenyan police tok say two pipo don die afta dem clash wit Tanzanian police.

Why protests dey rock Tanzania

Protesters don accuse di govment of undermining democracy, as di main opposition leader dey for jail and anoda opposition figure dey disqualified from di election, wey increase Samia chances of winning.

Di anger grow on Thursday afta di electoral commission start to dey announce di presidential results. Di result show say Samia get nearly 95% of di vote for south-western Mbea province.

She also take di lead for many oda constituencies for di mainland and for Zanzibar.

European Union (EU) lawmakers don call di election "fraud" wey don dey unfold for months".

On di day of di election, kasala bin burst between opposition supporters and the police.

Gunfire sound for di northern city of Mwanza, while clashes break out for di capital, Dodoma, and for di main city of Dar es Salaam, wey dey under heavy security and major roads dey blocked.

One day afta, Tanzanian military chief Gen Jacob Mkunda wey call for calm blame "bad characters wey no wish well for dis kontri" for di "damage to property and pipo" during di vote.

Kenya don warn dia citizens make dem no join for di protests wey dey hapun for di border town of Namanga, wia businesses don dey paralysed.

Tanzanian police bin fire tear gas to scata di protesters wey engage dem in running battles for most of di day.

US Embassy for Tanzania report say road to Dar es Salaam international airport dey among di several major routes wey remain close on Thursday.

One eyewitness tell BBC say im see hundreds of protesters wey march go Mwanza city, wey dey for di shores of Lake Victoria and get di biggest population afta Dar es Salaam.

"Afta barely 10 minutes, we begin dey hear gunfire and tear gas explosions," e tok.

"We see as dem dey evacuate some pipo wey injure."

Govment don order civil servants to work from home until Friday as tensions escalate.

Rights group Amnesty International say reports say one civilian and one police officer die for di clashes on Wednesday dey "deeply disturbing".

Govment don impose night-time curfew for Dar es Salaam, sources tell BBC say di city Muhimbili Hospital don receive wounded patients.

Internet connectivity still dey interupted across di kontri - situation wey Amnesty warn say fit further escalate di situation. Dem call on authorities to allow unrestricted access to information.

In di meantime, dem say protesters dey use one walkie-talkie app, wey di name na Zello, to plan dia next moves.

Final presidential results for mainland Tanzania dey expected by Saturday evening and e dey expected to spark more protests.

Dem don announce di presidential results for Tanzania semi-autonomous region of Zanzibar on Thursday, and di incumbent Hussein Mwinyi dey declared di winner.

President Samia dey widely expected to secure second term afta opposition candidates dey barred from running.

Di poll also dey expected to be free ride for her party, wey neva lose election since independence.

Tundu Lissu, di main opposition leader, dey for jail on treason charges, wey e deny, and im party no follow for di vote.

Di only oda serious contender, Luhaga Mpina of di ACT-Wazalendo party, dey disqualified on legal technicalities.

Di electoral commission clear sixteen minor parties, wey no get di public support to contest di elections.

Samia enta office for 2021 as Tanzania first female president afta di death of President John Magufuli.

Initially, dem hail her for relaxing political repression, but di political space since don small, as kontri pipo don accuse her govment of targeting critics through arrests plus a wave of abductions.