Ova seven hundred pipo dey find who go die wit dem

Angela Stevens dey hold her pikin picture

Wia dis foto come from, Phil Coomes/BBC

Wetin we call dis foto, Angela Stevens son, Brett, kill imsef afta e advertise for partner
    • Author, Angus Crawford & Tony Smith
    • Role, BBC Investigations correspondent & Senior investigations producer
  • Read am in 6 mins

One BBC investigation don find out say, ova 700 pipo for UK don post for one pro-suicide website, dey find pesin wey go follow dem die.

Di site wey we no go name get members only section wia users fit find suicide partner.

We don connect plenti double suicides to di "partners thread".

Di investigation also find out say predators don use di site to find vulnerable women.

For December 2019, Angela Stevens pikin of 28 years, Brett, travel from im house for di Midlands to Scotland to meet woman wey im bin click wit from di partner thread.

Dem join rent Airbnb and den take dia lives togeda.

Angela say, "I miss evritin about Brett, im smile, im infectious laugh."

Since her son die, she don spend years to torchlight di pro-suicide site especially di partner thread.

She say e be like dark version of dating site.

She kon add say, "na veri dangerous place. Wia else you go find partner to follow you die. E dey veri vile."

Di thread encourage users to end dia lives and even dey teach dem how dem fit do am.

Our analysis find ova 5,000 posts for di thread wey come from pipo all ova di wold.

We no go tok di name of di site or share di kain suicide dem dey recommend for dia.

One BBC investigation for March find out say more dan 130 British pipo fit don kill demsefs wt chemical wey di site promote.

Di BBC team arrange one anonymous account and check di number and wetin di messages tok.

Members go post dia age, sex, location and how dem wan take die, so dem go find pesin to die wit dem.

Helen Kite sister, Linda advertise for parner for 2023.

Helen say na forum wey dey "prey on desperate souls. Di parners section dey put dem for wia dem no fit comot till dem kpai".

Linda bin write say, "I be 54, female, wey base near London. I fit travel and pay for hotel if e beta pass. Obviously, e go good to chat first."

Linda contact man for di partners thread and meet am for one hotel for Romford, East London.

Dem take toxic chemical and die togeda for 1 July 2023.

Helen say dem find Linda dey "lie down beside di bodi of total stranger".

She believe say evri day "dem dey trap innocent victims wey dey find support witout di authorities to stop dem".

Di bad news no end like dat for Helen o. For September 2023, her oda sister, Sarah wey bin dey mourn Linda death, enta di site, take di same toxic chemical and die.

Predators

Anoda shocking part of di partners thread comot from di investigation.

Predators appear to dey use am target vulnerable and suicidal pipo especially women.

For 2022, one court for Glasgow hear how 31-year-old Craig McInally bin ansa plenti posts for di partners thread wey young women dem post to find pesin to die wit dem.

E persuade one of dem, one 25-year-old woman to come im flat and "practise" suicide.

McInally kon choke am sotay she lose consciousness.

Roberta Barbos
Wetin we call dis foto, Roberta Barbos be dey targeted by predator afta she advertise for partner thread

Dem arrest McInally for im house wia dem find out say e don give dat kain "advice and assistance" to oda suicidal women.

An na for di partners thread wey e meet all of di women.

One of dem na 22-year-old Romanian student Roberta Barbos.

For messages wey BBC see, McInally tell Roberta say e get plenti experience and promise say e go dey wit am all di way.

She meet McInally once and den refuse to see am again but still take her life alone for February 2020.

Roberta mama, Maria Barbos say, "E be like horror feem, from anoda world. I bin no fit believe say website like dat fit exist. Dem be sick minds."

Dem give McInally an Order of Lifelong Restriction (OLR). Na di sentence for Scotland wey dem dey keep for di most serious cases of sexual and violent offenses wey no enta murder.

Dis mean say e dey sentenced to minimum of two years and three months for prison and go dey under supervision or di rest of im life.

Roberta mama Marie
Wetin we call dis foto, Dis na Roberta mama, Marie

Di investigation find out say in di past two years some forum users don go abroad to meet partners.

We don see two cases wia men from US go UK to go meet and "assist" vulnerable young women wit dia plans to commit suicide.

We no dey name any of di pipo wey dey inside becos of dia families.

For one case, one man from Minnesota go UK and stay for hotel for ova one week wit one 21-year-old wey e meet for di thread.

For di 11th day wey dem dey share di hotel room, di young woman take toxic chemical and die.

Di man claim say e bin dey sleep wen she take di substance and call di emergency services wen e realise wetin she do.

Police arrest and question am but release am witout charge and allow am to fly go home.

For second case, one man from Florida dey believed to arrange to meet four pipo wey e meet for di thread, one of dem from di UK.

Di investigations find say in one case e give one woman for US gun.

Police bin find am bifor she carry out her suicide plan.

Dis man don admit say e fly go London and meet one young British woman for hotel.

We no know who di woman be or wetin happun to am.

Dem no charge di man wit any offence.

Wetin dem fit do about dis mata?

Di previous Conservative goment introduce di Online Safety Act for 2023 wey dem say go allow di regulator Ofcome to act against di website.

Di new Labour administration say e dey committed to di new law and "dey determined to take action wey go stop dis harm online".

Tok-tok pesin tell us say, "we want new protections as soon as possible."

Julie Bentley wey be di chief executive of Samaritans say di act go only prevent harm if e get real teeth: "Di goment and Ofcom gatz make ensure say small platforms wey dey pose high risk to di public dey regulated to di fullest extent of di law."

Ofcom still dey find di best way to enforce di law as dia enforcement power no go dey active till di end of di year.

Dem also don contact di site administrators.

However, dem say di site dey small and dey based for US so e go hard to take legal action against am.

But di investigation for di site find out say one of di principal moderators na woman wey dey for west of England.

We no go name am becos of worry for her mental health.

Ofcome chief executive Melanie Dawes say threats of law enforcement neva change anytin.

She say, "We bin contact dem and tell dem say e dey illegal and e dey promote suicide. At first, dem stop to make am available for UK users but dem don start again."

Brett picture

Wia dis foto come from, Phil Coomes/BBC

Families of di deceased say di partners thread dey directly promote suicide wey dey illegal for di UK weda e dey online or offline.

Angela Stevens say, "I tink na predator dream to get dat kain partners thread. Becos e dey veri open to abuse and I find dat really, really scary."