Dem recova bodi of British billionaire Mike Lynch afta Bayesian luxury yacht sink off di coast of Sicily

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem don find di body of British tech entrepreneur Mike Lynch days afta im yacht sink inside di coast of Sicily.
Di 59-year-old bin dey on holiday for im boat wit family, members of im business and legal inner circle, wen di yacht bin sink afta one powerful storm strike am for Monday morning.
One source wey dey close to di family bin tell di BBC say dem don recova di bodi of di billionaire.
Di source also say e dey possible say di pesin wey still dey miss na Lynch 18-year-old daughter, Hannah.
Lynch na important pesin for di UK tech industry since e help to establish Cambridge Neurodynamics, di computer-based detection and recognition of fingerprints.
Dis new tori dey come afta one man bin die and six pipo miss wen di luxury yacht bin sink sake of bad weather conditions off di coast of Sicily.
Di 56m British-flagged Bayesian bin dey carry 22 pipo - 12 passengers and 10 crew - wen one heavy storm strike early on Monday.
Dem rescue fifteen pipo and search operation bin go on for dose wey bin dey miss - wey include di British tech tycoon Mike Lynch.
Dis na wetin we know about di tragedy so far, and how e take happun.
Tori be say Lynch bin invite guests to im yacht to celebrate di conclusion of di court case wey im win.
Lynch co-found di British tech firm Autonomy wey im sell for 2011 to US computing giant Hewlett-Packard (HP) for $11bn (£8.6bn). Dis na how im legal battle begin.
How di yacht take sink?
Na sake of one sudden and powerful storm strike di Bayesian for di early hours of Monday morning, witnesses tok.
Di storm bin dey so strong and e cause waterspouts, or rotating columns of air and mist, to appear ova di sea.
Witnesses tell Italian news agency Ansa say di Bayesian anchor bin dey down wen di storm strike, as e cause di 72m (236ft) aluminium mast to break in half and e make di ship lose im balance and e sink.
E disappear go under di water at about 05:00 local time (04:00 BST).
Karsten Borner, captain of one nearby boat, tok afta di storm bin pass say, di crew bin notice say di yacht wey dey dia back don disappear.
"We see one red flare, so my first mate and I bin go di position, and we see dis life raft dey drift," e tell Reuters.
Im crew bin take on board some survivors, wey include three pipo wey dey seriously injured.

Wia dis foto come from, Getty Images
Anoda witness, Fabio Cefalù, captain of one trawler, say im bin wan go on a fishing trip wen e see flashes of lightning, so im stay for di harbour.
"At about 4:15:am we see one flare for di sea," e tok, according to di EVN news agency reports.
"We bin wait make dis waterspout pass. Afta 10 minutes, we comot go di sea and we see cushions plus wetin remain of di boat [wey sink], and evritin wey dey on di deck, at sea. However, we no see any bodi for di sea.”


Wia dis foto come from, Facebook
One of di survivors, British tourist Charlotte Golunski, tell Italian newspaper La Repubblica how she hold her one-year-old daughter Sofia up make she for no drown.
She say di two of dem plus her partner James bin survive only becos dem dey on di deck wen di yacht sink.
Na “thunder, lightning and waves wey make our boat dance”, wake us and e feel like "di end of di world" bifor e throw dem into di water.
Charlotte say: "For two seconds, I and my daughter bin dey inside di sea den I quickly hug am even as di waves dey serious."
She add: "I hold her afloat wit all my strength, my arms stretch upwards make she for no drown.
"Evri wia dark. For di water I no fit keep my eyes open. I shout for help but all I dey hear around me na di shout of oda pipo."
Who dey on board?

Wia dis foto come from, Getty Images
22 pipo bin dey on board wen di storm hit, dem include 12 passengers and 10 crew.
Previously, dem recova one deadi-bodi - di Palermo coastguard say na di ship cook.
Among di six pipo wey bin dey miss na 59-year-old tech entrepreneur Mike Lynch, wey some pipo sabi as "British Bill Gates".
Oga Lynch bin start di software giant Autonomy for 1996 and dem make am OBE for services to enterprise for 2006.
For June, dem clear am on top accuse say e carry out massive fraud wey relate to one 11 billion dollar (£8.64 billion) sale to US company Hewlett Packard.
E later tell BBC for one interview say, im don dey able to prove im innocence only becos e get di wealth to pay di ogbonge legal fees wey dey required.
Sicily civil protection agency also confam give BBC say Mr Lynch 18-year-old daughter Hannah, Morgan Stanley International bank chairman Jonathan Bloomer, and Clifford Chance lawyer Chris Morvillo dey among those wey dey miss.
La Repubblica report say di six missing pipo include four British nationals and two Americans.
Who dem bin declare missing?
Na six pipo dem report say bin dey miss. So far, we know di names of five:
British technology tycoon Mike Lynch
Lynch 18-year-old daughter Hannah
Jonathan Bloomer, Morgan Stanley Bank International chairman
Judy Bloomer, Bloomer's wife
Chris Morvillo, Clifford Chance lawyer
Meanwhile, 15 people have been rescued. Among them are:
Lynch's wife, Angela Bacares
Charlotte Golunski, her husband James and their one-year-old daughter Sophie
Ayla Ronald, a New Zealand national working at Clifford Chance and her partner
Charlotte Golunski, her husband and daughter Sofia dey among those wey dey rescued and dem no get any injury, but dem go hospital for check-ups.
She say dem bin dey on di yacht wit a group of colleagues.
Di daily Il Giornale di Sicilia newspaper bin report say di vessel bin get mostly British passengers on board, but also pipo from New Zealand, Sri Lanka, Ireland and British-French citizens.
One doctor for Palermo say di "very tired" survivors bin "constantly dey ask about di missing pipo".
Dr Domenico Cipolla tell Reuters say one woman wey im treat bin describe di trip as a "corporate holiday", and some of those on board dey "very young".
"Plenty work colleagues, friends, a few husbands, wives, or a couple of friends bin join dem," e add.

Wetin be di Bayesian, and who get am?
Di superyacht fit accommodate up to 12 guests for six suites, and e dey listed for rent for up to 195,000 euros (£166,000 ) a week.
Na one Italian company Perini Navi build am for 2008.
Di Bayesian registered owner dey listed as Revtom Ltd, wey dey based on di Isle of Man.
Di yacht name come from di Bayesian theory, wey Mr Lynch PhD thesis and di software wia e take make im money dey based on.
Dem name Oga Lynch wife Ms Bacares as di sole legal owner of Revtom, wey dey registered for di Isle of Man.
Di Bayesian bin complete some sailings in recent days, as dem stop for various ports for Sicily, according to ship-tracking website VesselFinder.
One tok-tok pesin for Camper and Nicholsons International, di firm wey dey manage di 2008-built boat, tell BBC Verify: "Our priority na to assist wit di ongoing search and provide all necessary support give di rescued passengers and crew."
Who be Mike Lynch

Wia dis foto come from, Getty Images
Mike Lynch wey some sabi as "di British Bill Gates" na businessman wey make im fortune for di IT industry.
Lynch bin co-found software company Autonomy for Cambridge for 1996 and e grow to become one of di UK leading tech companies.
Dis success of im company bin make am sell to Hewlett-Packard (HP) for $11bn (£8.6bn) for 2011. Di deal make £500m ($647m) for Lynch.
Just a year later, HP write down di value of Autonomy to $8.8bn sake of claim say Lynch bin too increase di value.
Wit plenti years of legal battles, US prosecutors bring charges against Lynch for 2018 say e increase di value of im company.
Who be Chris Morvillo?
Lawyer Chris Morvillo dey among those wey dey miss.
Morvillo don work on high profile corruption cases, wey include di recent acquittal of UK tech tycoon Mike Lynch – wey also dey miss.
Several reports suggest say di yacht trip na celebration of di acquittal.
As an assistant US attorney for di southern district of New York from 1999 to 2005, Morvillo bin work on di criminal investigation wey surround di 2001 terrorist attacks on di World Trade Center.
Since 2011, e don be partner do di Clifford Chance law firm for New York.
Who be Jonathan Bloomer?
Jonathan Bloomer na one of di six pipo wey bin dey miss.
E be di chairman of Morgan Stanley Bank International and insurance company Hiscox.
Di 70-year-old Briton dey educated for Imperial College London and don previously serve on a number of company boards.










