Who be 'Nota' Baloyi wey rights commission dey drag over alleged hate and anti-white comments

Wia dis foto come from, @Nota Nhlamulo Baloyi/Instagram
Di South African Human Rights Commission say dem go take court actions against Nhlamulo 'Nota' Baloyi.
Dis na sake of im alleged hate speech against white pipo for South Africa.
Di commission tok say dia decision na based on wetin Baloyi tok on 17 February 2025, for one episode on "The Hustlers Corner SA" wey dem publish for dia YouTube page wia im tok about white pipo.
"Following di publication of di podcast, di commission open dia own investigation and receive complaints from across di kontri for Gauteng Provincial Office," e tok
"Di commission prayers go include public apology, diversity and sensitivity training, community service, and monetary fine, but dis no be di limit to dis.
"Complainants wey dey seek oda remedies go need open crimen injuria case wit di South African Police Service."
Dis dey happun as US President Donald Trump dey threaten to sanction South Africa over President Cyril Ramaphosa land policy.
Oga Trump tok say e go cut all future funding to South Africa sake of accuse say di kontri dey take pipo land and dey treat "certain classes of pipo very bad".
End of Di one wey oda users dey read well well
President Ramaphosa bin recently sign a new law wey allow goment to seize pipo land witout compensation in certain circumstances.
Land ownership for South Africa na controversial issue bicos na di oyibo pipo for di kontri still get most of di farmlands, 30 years afta di end of di racist system of apartheid.
However, e no clear weda 'Nato' dey also react to President Trum threat to sanction im kontri.
Nota na popular music executive and musician for South Africa and im dey popular for promoting "black culture".
"SAHRC find prima facie case of hate speech" by Boloyi, di commission tok for statement.
Inside di video on "The Hustlers Corner SA" , Baloyi tok say "white pipo no get moral authority to follow me tok about racism, I know how e feel to get generations of fatherless cousins."
E tok say im mama dey handle too much financial responsibility to her family members becos her brodas don die.
Baloyi tok say black pipo wey dey live for South Africa na subject of white pipo economic and cultural influence and e dey make black pipo to commit crime becos of di system.
"As a white pesin, you don ever go to hospital make dem tell you say, your cousins parents don die becos of killings on mass scale," e claim.
"White pipo dey use foreigners to suppress black South Africans, dem dey give dem jobs but dem no dey give blacks jobs or respect."
Who be 'Nota' Baloyi

Wia dis foto come from, @Nota Nhlamulo Baloyi/Facebook
Nato parents born am in 1990 for Parktown, South Africa wia dem raise am until im drop out from secondary to begin live on im own.
Di 35-year-old rapper dey always face different controversies ontop social media. Dem bin don suspend im Twitter page bifor. E recently divorce from him ex-wife Gugulethu Khumalo Berita, wey be Zimbawean-born South African star.
She dey popular for her hit songs Thandolwethu and Nguwe Wedwa.














