Wetin dey inside Davido '5ive' album

Foto of Davido

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Grammy award nominee and popular afrobeats star David Adeleke wey pipo sabi as Davido dey make headlines sake of im new album.

For im bio on im official X page Davide write "5ive out now" Nigerian multi awards winner release im fifth studio album wey im title '5ive'

Tori be say di album na to give im fans small of wetin go dey inside di main album wen im finally release am.

Davido bin don drop some singles wey dey inside di album wia im do collabo wit some ogbonge Nigerian artistes like Chike, Odumodublvck and YG Marley.

Im also feature artistes like Chris Brown, Victony, Omah Lay inside di album.

Di album '5ive' dey come two years afta im last studio album 'Timeless', wey bin reach number one for Billboard World Albums Chart.

Wetin dey inside dis album

For inside dis album wey get 17 tracks Davido bin tok say im put all im heart for di songs wey dey inside di album.

Na for December, 2025 im bin tok about di energy wey dey inside di album.

"Di journey continue for 2025 wit my new album, 5IVE!! Dis one na straight from di heart - my story, my truth, my growth."

Na for inside dis post im bin also annound say im dey release di single wey im title "Funds" wia im do collabo wit Odumodublvck and Chike.

Davido bin add say di album na for go getters and pipo wey dey ride wit am.

"Dis one na for dreamers, di go getters and everyone wey dey pursue wetin be dia own!.im write.

How fans react to dis new album

Davido fans react to dis album since e first announce am for December, 2024.

For some of di fans, dem believe say di album na di best wey Davido drop while odas still take time to tok about di about di are work wey dey on top di cover say e make sense gan but weda di music also make sense, na music lovers go determine.

Davido na one of Nigeria best music exports to di world. E don perform for big stages wey include di 2022 Fifa World Cup closing ceremony for Qatar.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2

Davido profile

Dem born Davido, wey im real name na David Adedeji Adeleke on 21 November, 1992.

Davido, na Nigerian-American singer, songwriter and record producer.

Im be one of di most popular and influential African nusician.

Davido don win plenti awards from di Next Rated Award for 2012 till date.

Im be di oga of im own record lable Davido Music Worldwide (DMW).

Davido release im second studio album A Good Time for November 2019. New African Magazine name am as di top 100 most influential Africans for 2019.

For February 2021, Next Time list Davido as one of di 100 most influential influential pipo for di world.

Time Magazine also name am as one of di biggest voices for Afrobeats genre.

Davido lose im first son Ifeanyi for November last 2022.

Im marry im long time partner Chioma and she born twins afta dem lose dia son Ifeanyi.