Who be Choi Jeong Woo Kdrama actor wey die at 68

Wia dis foto come from, Bless ENT
Korean veteran actor, Choi Jeong Woo don die on Children Day at di age of 68, im management tok.
Di death bin dey announced by im agency, wey be Bless Ent wey release short statement for im death but no tok wetin cause am.
"Actor Choi Jeong Woo don die!", di statement tok.
Although according to di South Korean News Agency, Yonhap, Oga Choi bin dey suffer depression and panic disorder.
Howeva di statement add say, "di cause of death neva dey confamed".
Di statement, according to di iMBC wey bin break di tori, im burial go happun on Thursday May 29.
Dem add say, "Im funeral home na for di Gimpo Woori funeral home and di funeral go start by 10am for di 29th".
Di 68 year old actor bin star for plenti ogbonge series ova di course of im career.
Some di ogbonge work wey e act inside na The Legend of di Blue Sea wey be di first Korean series wey go Premier for Netflix, di same day e comot.
Di actor wey get almost 40 years experience for di work bin don get credits for KDramas, Korean movies and Korean theatre.
Oda of im work include Master's Sun, City Hunter, Doctor Stranger, Be Mt Dream Family among odas.
Im most recent release na for The Tale of Lady Ok wia e act as Park Jun Gi wey bin act as di villian of di traditional drama.
Ova di course of im long career wey start for di 1970s, e don dey nominated for four awards and win two.
Di two wey im win na for digrand prize for di Seoul Theatre festival for 1990 and di 36th Dong-A Theatre Award for 1999 as Best Actor for im work.
For di 2000s, e come get two ogbonge nominations of Best Actor for Miniseries for di SBS Drama Awards for im work for Master's Sun and di KBS Drama Excellence Award for Actor for Daily Drama for im role for Be My Dream Family.
Many pipo gada for social media to mourn im death even as some pipo say e be dia "favorite on screen adjussi".
Odas still tok about which of di shows wey im act for im life dem go use remember am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4