Simon Ekpa lawyer give details about plan to free Ipob promoter

Read am in 4 mins

New informate don emerge about di current situation of Simon Ekpa of di proscribed militant group Indegenous Pipo of Biafra (Ipob) wey Finnish authorities arrest.

Simon Ekpa dey face alleged charges wey surround terrorism activities. Dem gbab Ekpa and throw am into prison.

Tori be say na inside di Kylmäkoski prison dem keep Simon Ekpa pending wen dem go decide ontop im case, dis na wetin local media for Finland bin report.

Di BBC Pidgin reach out to Simon Ekpa lawyer ontop dis matter and e give some new updates concerning di trial of di Ipob man.

But rememba say report bin come for November 2024 say di District Court of Päijät-Häme send Ekpa, go prison go chill on probable cause and on suspicion of publicly inciting pipo to commit crime wit terrorist intent.

Meanwhile, just few days ago, authorities for Finland bin chook hand inside di matter of Simon Ekpa wia dem take actions ontop im assets.

Ekpa bin marry a Finnish woman and dem bin get one child who im bin dey show off for social media as im also sabi speak Finnish language. And Ekpa don become politician for Finland as e dey even serve for di Public Transport Board.

No be only Simon Ekpa dey inside dis gbege, e also get some oda four pipo wey dey for di alleged terrorism activities and di freezing of assets go affect dem too.

Di big kwestions still dey about wen dem go carry Simon ekpa go court for trial. And also if oda amended charges dey.

Dis no be dis first time wey Ekpa go dey enta gbege for Finland and even Nigerian govment too.

During di 2023 general elections for Nigeria, Finland authorities bin gbab Simon Ekpa sake of di tok tok wey put am for gbege.

Na di Nigerian goment bin ask make dem check di activities of Ekpa becos e bin dey call for a boycott of di general elections for Nigeria dat time.

Dem gbab Ekpa for February 2023, but di Finnish police later release am afta dem ask am kwesion for some hours.

Now, e dey face anoda gbege again. BBC Pidgin find more update on wetin lead to di arrest of Ekpa.

Simon Ekpa lawyer tok on arrest

To find out why di Finland govment bin go afta Simon Ekpa and wetin be in offence for di kontri, we follow Ilkka Kopra, wey be im lawyer tok.

Mr Kopra confam say true-true Simon Ekpa dey prison, but add say na di decision of di Finland court of law to put Ekpa for prison.

Lawyer Kopra say dem neva sabi how long e go dey for di prison as dem dey wait for di trial of Ekpa.

"Mr Ekpa dey imprisoned by di decision of the Finnish Court of Law. We no know yet how long e go stay prison or wen di trial go take place," di lawyer tok through email reply.

Meanwhile, e say dem dey try do everitin within dia power to ensure say e dey free, but e neva clear wen tins go dey sorted.

According to Kopra, e say im no go fit tok much on di matter but e " hope to do all to get am free as soon as possible."

Simon Ekpa dey come Nigeria?

E still get anoda kwesion if dem go extradite Simon Ekpa to Nigeria.

Normally, no sovereign nation dey under obligation to surrender a criminal to anoda nation, bicos evri sovereign nation get legal authority over pipo wey dey live within dia borders.

Dis na why bifor extradition go happun, di two nations involved suppose don get extradition agreement between dem.

Also, di nation wey dey request for di extradition must to get proof say di arrested suspect bin commit di crime for dia territory, or say di crime affect pipo wey dey live for dia territory.

Meanwhile, for June 2024, Nigeria Chief of Defence Staff, Christopher Musa, bin accuse di Finnish govment say dem dey give Simon Ekpa protection and e call di Nigeria goment to explore diplomatic options to make sure say di secessionist leader dey arrested.

Now wey, Finland govment don gbab Simon Ekpa, Tukur Gusau di tok-tok pesin for di Nigeria Defence react to di arrest.

E say di Chief of Defence Staff dey happy wit Ekpa arrest for Finland, "wit di hope say dis go be a step towards im extradition to Nigeria so dat he go face justice".

But wetin be di possibility of di Finnish goment extraditing Ekpa to Nigeria to face trial?