Why Trump and Zelensky dey do gbas-gbos

Read am in 5 mins

Di war of words between America President Donald Trump and Ukraine President Volodymyr Zelensky start on Tuesday, 18 February wit comments wey Oga Trump make.

For one news conference for Mar-A-Lago for Florida, Oga Trump bin blame Ukraine for di war. "You no suppose ever start di war. You suppose don make deal," e tok.

Trump no mention am say na Russian President Vladimir Putin decide to attack Ukraine for February 2022.

On Wednesday, Ukrainian President Volodymyr Zelensky, as e dey react to US-Russia toks for Saudi Arabia, discussions from which dem exclude Kyiv, tell tori pipo for Kyiv say: "We dey see plenty disinformation and e dey come from Russia. Wit all due respect to President Donald Trump as a leader... e dey live for dis disinformation space."

E add say im believe say "di United States help Putin to break out of years of isolation".

Later, Trump label Zelensky as "dictator" and say di leader do "terrible job".

Trump add say di only thing Zelensky "dey really good at na playing Joe Biden like a fiddle".

Wetin Trump tok about Zelensky

On Wednesday, 19 February, US President Donald Trump bin post one very long attack on Ukraine Volodymyr Zelensky.

On im Truth Social platform, Trump bin call di Ukrainian leader "dictator" and add say e "no gree conduct elections."

"I love Ukraine, but Zelensky do terrible job, e destroy im kontri, and millions of pipo die unnecessarily," e post.

"E refuse to do elections. E dey very low for Ukrainian polls. How you fit dey high wen dem don destroy all di cities for your kontri? Trump tok.

Di US president also lament di millions of dollars US don spend for di war.

"Tink of am, one modest successful comedian Volodymr Zelensky tok di US into spending 4350 Billion Dollars, to go war wey dem no go ever win, war wey no even suppose start in di first place, war wey dem no fit ever settle without America and "Trump.

"Di US don spend 4200 Billion Dollars pass Europe, e sure say Europe go get dia money back, but notin dey for di US.

E also tok about im attempt to get rare-earth minerals from Ukraine, e accuse Zelensky government of "breaking di deal".

Di White House confam say Trump post na direct response to Zelensky "disinformation" comments.

Wetin Zelensky tok about di katakata wit di US leader

Ukraine President Volodymyr Zelensky bin para afta dem shun am from di US-Russia tok-tok wey hold for Saudi Arabia.

E say na "surprise" say im kontri no dey invited to di tok-tok for Saudi Arabia to end di war wit Russia.

As dem no invite dem to di summit, Oga Zelensky say Trump "dey live for disinformation space" wey Russia create.

Dis comment vex US president and e call Zelensky dictator.

On Wednesday, 19 February, di Ukrainian leader say di world get di choice to be "wit Putin or wit peace".

Also, for one social media post, Zelensky say peace fit dey more secure wit di US and Europe.

Earlier, Zelensky bin also reject Trump attempts to access Ukraine rare minerals, e say dem no offer any security guarantees in exchange.

Zelensky five-year term for office suppose end for 2024. However, Ukraine dey under martial law since Russia launch full-scale invasion for February 2022 wey make dem suspend elections for di kontri.

Dis fit be why di gbasgbos dey happun

President Trump and President Zelensky no ever get smooth relationship.

One phone call on 25 July 2019 bin lead to Trump first impeachment. Dem accuse am say e break di law as e pressure Ukraine leader for 2019 to dig up damaging information on im 2020 rival Joe Biden.

Asking foreign entities to help am win di election dey illegal, Democrats tok. But Trump deny say im no do anytin wey dey wrong. Dem impeach am for December of 2019 but Senate clear am.

But dat phone call bin also lead to one Justice Department referral to determine weda wetin Trump do na violation of one campaign finance law.

Prosecutors no gree investigate but di transcript from di case show say Trump bin offer Zelensky support from di US Justice Department to investigate Biden.

Trump later defend am say e dey normal and fine, even Zelensky too.

Di Ukrainian leader don dey try to tread a fine line as different reality dey arise for am under Trump.

Trump claims about di war na true?

Ukrainian authorities bin express dissatisfaction say dem no dey part of di tok-tok for Riyadh. But Trump dismiss these concerns, e tell tori pipo say Ukraine get three years to end di war, as e be like say e dey blame Kyiv for say na dem start di conflict.

"You no suppose ever start am," e tok. Di Kremlin don previously accuse Ukraine say na dem start war against Russia.

"Na dem start di war for 2014. Our goal na to stop dis war. And no be us start dis war for 2022," Russian President Vladimir Putin tell US talk show host Tucker Carlson for February 2024.

Ukraine no start di war. Russia bin launch one full-scale invasion of Ukraine for February 2022, afta dem capture Crimea for 2014.

Dem seize di area afta one popular protests remove Ukraine pro-Russian president.

Putin for di start of di war tok say di aim of di operation na to "demilitarise and denazify" di pro-Western government of Volodymyr Zelensky and stop di kontri from joining Nato.