You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Russia say Christmas Day attack on Ukraine na success, President Zelensky react
As millions of pipo for Ukraine dey celebrate Christmas Day, Russia launch a major missile and drone attack on di kontri energy infrastructure
Cities for Ukraine bin come under large-scale attack on Christmas Day morning.
Di attack na from Russian ballistic and cruise missiles.
For Kyiv, civilians dey spend Christmas morning for shelters in metro stations. afta di attack hit di city.
For di past hour, di Ukrainian air force warn say "enemy strike drones" dey head to Kyiv from di north-east.
According to di energy minister German Galushchenko, di attack dey hit di energy system.
"Di enemy dey carry out a mass attack on di energy system again."
E say restrictions on electricity supply don dey in place to cope wit di strikes.
Na number of explosions don rock Kharkiv, Ukraine second-largest city, including Dnipro wey come under attack.
Preliminary reports from local officials say injuries dey.
According to Kharkiv mayor, Ihor Terekhov, di city dey under a "massive" missile strike.
E say na series of explosions dem hear and at least three injuries, wit two pipo dey for "serious condition".
Buildings don also dey reportedly damaged.
Dis attack dey come afta Russia President Vladimir Putin tok say e dey ready to compromise ova Ukraine in possible tok-tok wit US President-elect Donald Trump on ending di war.
Putin tok say im no get conditions for starting tok-tok wit di Ukrainian authorities.
Even though Trump bin vow to swiftly end di conflict, but e neva give any detail on how e fit achieve dat.
President Zelensky react
Ukrainian President Volodymyr Zelensky say Russia make a "conscious choice" to launch attacks for Christmas Day
Ukraine Air Force says dem detect 184 missiles and drones - dem shoot down many or dem miss dia target
Di president say more dan 70 missiles bin dey fired, plus 100 drones. Dem shoot down more dan 50 missiles.
"Evri Russian massive strike take time to prepare. No be spontaneous decision. Na conscious choice not only of targets, but also of time and date.
"Today, Putin deliberately choose Christmas for attack. Wetin fit dey fit dey more inhumane? More dan 70 missiles, including ballistic ones, and more dan 100 strike drones. Di targets na our energy sector. Dem continue to fight for a blackout in Ukraine."
Ukraine largest private energy company, DTEK, say Russia don strike dia thermal power plants wey cause "serious" damage to equipment.
DTEK say dis na di 13th major attack on di Ukrainian energy sector dis year.