Ukraine say dem 'sink' Russian Black Sea ship Sergei Kotov for one drone attack

Footage wey Ukraine release wey claim to show di Sergey Kotov wey drones scata

Wia dis foto come from, Ministry Of Defence Of Ukraine

Wetin we call dis foto, Footage wey Ukraine release wey claim to show di Sergey Kotov wey drones scata

One Russian patrol ship don sink afta sea drones attack am for Black Sea, according to Ukrainian intelligence.

Di Sergei Kotov allegedly come under attack for di early hours of Tuesday morning.

Ukraine military intelligence service tok say di stern of di Black Sea fleet ship suffer damage plus di right and left sides.

Di Kremlin neva comment on di mata. But some Russian pro-war bloggers don confam di sinking of di Sergei Kotov.

Ukrainian intelligence official Andrii Yusov tell Ukrainian broadcaster RFERL say, sailors on board die and injure.

Di Sergei Kotov na one of four patrol ships dem complete for di Russian Navy Project 22160. E don come under attack before by Ukraine for September last year.

Di Sergei Kotov

Wia dis foto come from, NORTHERN PROJECT DESIGN BUREAU

Wetin we call dis foto, Dem launch di Sergei Kotov for 2021

According to Ukraine, di vessel bin play role for di attack on Snake Island on di first day of di full-scale invasion on Ukraine for February 2022, along wit di Moskva cruiser.

Ukraine sink di Moskva for 2022.

Russia illegally capture di Crimean peninsula from Ukraine almost 10 years ago.

In recent months, Ukraine don repeatedly hit Russia Black Sea fleet wey dey stationed on di peninsula.

Ukraine tok say di cost of di Sergei Kotov ship dem sink na $65m (£51.2m), dem add say dem hit di ship near di Kerch Strait, wey separate Crimea from Russia.

One video dem post on social media appear to show di moment wen dem hit di ship.

BBC Verify don look di video wey Ukraine Main Intelligence Directorate release, wey dem tok say na video of di attack.

Di vessel get similar structural features to one patrol ship wey be of di same class wit di Sergei Kotov. However, no visible number on di side, so di footage no make am clear if na di same ship.

No oda versions of di video don appear on reverse image searches, wey suggest say dem recently release dis video.

According to di International Institute for Strategic Studies think tank, dem don destroy or damage at least 13 Russian naval ships since di conflict start.

Last month, dem sink anoda Russian amphibious ship, di Caesar Kunikov, for one drone attack just south of di town of Yalta.

At di time, Ukraine intelligence directorate release video of wetin dem tok say na Magura V5 sea drones wey strike di Caesar Kunikov.