Di health benefits of coconut

Coconut na one fruit wey dey give plenti value becos every part of am dey useful. From di meat to di coconut water to di shell and husk, every part of am get benefit.

Weda na for food, drink, medicine, to decorate house, pesin fit use every part of coconut in one way or di oda.

Di scientific name for coconut tree na Cocos Nucifera. Cocos Nuciferana di only type of palm tree wey dey produce coconuts.

Tori be say e originate from India and Southeast Asia, and some oda tori suggest say ocean currents, explorers carry di fruit to oda locations.

Today, coconuts dey grow for warm climates around di world, like di Caribbean, the South Pacific, and parts of Africa, South America, and U.S.

Some of di oda uses of coconut aside from di flesh wey pesin fit chop like dat include:

  • Coconut water - to drink
  • Coconut oil - to cook or moisturise di skin and hair
  • Coconut milk

While coconuts get a lot of nutritional value, sabi pipo draw ear say e also get plenti saturated fat, so make pesin eat am in moderation.

Coconut health benefits

According to sabi pipo WebMD, coconut contain protein and fiber, as well as many essential minerals like Iron, Manganese, Copper and Magnesium.

While coconut wey dey low in sugar, get a high fat content.

Di sabi pipo say pipo don use coconut as part of traditional medicine as di fruit dey useful to help with inflammation, treat diarrhoea and menstrual issues.

Clinical Nutritionist, Funmilola Ijiwola with di Lagos State Health Service Commission tok say coconut dey rich in fats, e get nutrients like fiber, vitamin B, e dey low carbohydrates but e get oda essential minerals like copper, phosphorus, manganese and iron while di coconut water dey rich in electrolytes.

Some of di benefit wey pesin fit get wen e eat coconut according am na say:

  • Coconut na amazing energy booster. Pipo wey wey do exercise dey advised to drink coconut water before, during and after exercise to charge dia stamina and e dey replace lost electrolytes for di bodi especially after serious exercise.
  • Coconut dey good for bones. Sake of di manganese wey dey essential for bone health and phosphorus wey e also get, taking a healthy portion of fresh coconut meat dey provide 30% of daily recommended value wey dey need for good bone health.
  • Coconut dey rich in fiber. Ijiwola say human beings need fiber to properly manage sugar for dia system as e dey regulate blood sugar at healthy levels and coconut dey loaded with fiber.
  • Coconut dey rich in antioxidants and e get powerful antibacterial properties wey fit support better blood sugar control.
  • Coconut dey offer protection against Alzheimer’s disease. Researchers for Central Michigan University report say di medium chain fatty acid wey dey inside coconut dey form ketones, dat na five chemicals wey dey break down fats.

Sabi pipo don find say coconut husk-fiber extracts dey reduce pain and inflammation for mice. Dem also find say coconut water dey show antidiabetic effects in animal studies and e reduce blood pressure in hypertensive rats. But e no dey clear if dis benefits carry over to humans.

Scientists also find say coconut extracts, particularly from di husk, show some antimicrobial properties and e dey effective against various bacteria, fungi, and viruses in lab tests.

Coconut endocarp and virgin coconut oil also get high antioxidant activity, wey dey good for resisting harmful molecules for di body.

Ijiwola add say oda products from coconut like coconut milk, coconut oil and coconut flour na healthy foods wey good for health.

"Di coconut milk na good alternative for pipo wey dey lactose intolerant. So dem fit use an replace milk products wey dem dey react to and e go good for dem.

Coconut flour na anoda good food as e dey gluten- free so pipo wey dey get gluten problem fit use am." She tok.

Coconut oil dey useful for cooking and also for hair and skin care. Coconut oil also:

  • Contain medium-chain fatty acids
  • Get anti-inflammatory, anti-microbial and anti-fungal properties
  • Fit dey helpful in di treatment of some skin conditions
  • Fit protect hair from damage
  • Fit dey helpful to prevent dental caries.

But Ijiwola advise moderation as a guide especially for pipo wey get oda underlying health challenges like diabetes and hypertension as coconut dey very rich in fats.

"Just like for oda foods dem, e good make pipo consume coconut in moderation, but na very good fruit wey get various uses and if you use am well, every part of di coconut dey useful with little to no waste." Ijiwola tok.

Oda parts of di fruit like di coconut husk fit dey used to make floor mats, brushes, ropes and swing.

Di leaves dem fit use make broom and roof thatch while di trunk of di coconut tree dem fit use build house, boat, make drums and furniture.