You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Nobodi dey above di law, justice go prevail' - Deposed Emir of Kano call for calm
Alhaji Aminu Ado Bayero, di depose Emir of Kano, don tok say no bodi dey above di law, as im ask pipo to dey calm.
E tok dis one for inside mini-palace wia e dey since e go back di state afta dem dethrone am. Di deposed Emir tok say justice go prevail.
Bayero promise say e go accept anytin wey di law tok, as e add say Kano na important state for Nigeria.
"We call on di authorities make dem do justice for dis mata. Kano na veri influential state for Nigeria. Anytin wey affect Kano affect Nigeria. We pray say Allah go bless Kano wit responsible and just leaders," di former Emir tok.
Earlier, di Kano State Govnor Abba Yusuf bin order di immediate arrest of di overthrown Emir.
Di govnor order di state commissioner of police to arrest am on top accuse say e dey create tension for di state.
Di directive dey come two days afta di govnor remove Bayero from di throne.
For one statement wey di tok-tok pesin to di govnor, Sanusi Bature Dawakin Tofa issue on Saturday morning, e tok say dem allegedly smuggle di former Emir enta Kano city on Friday night inside attempt to reclaim di palace forcefully.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Tofa add say di new emir Sanusi Lamido Sanusi don land di palace in di company of di govnor, lawmakers plus oda top dignitaries for di state.
“As di Chief security officer of di state, im Excellency di Executive Govnor of Kano State, Alhaji Abba Kabir Yusuf, don direct di Commissioner of Police to arrest di deposed Emir wit immediate effect for disturbance of public peace and trying to destroy di relative peace di state dey enjoy,” di statement tok.
Meanwhile, di Kano State Police Command don call for peaceful coexistence within di state.
Di commissioner of police Usaini Gumel for one press conference emphasise di importance of obeying court order wey one Federal High Court for Kano issue on 23 May, 2024.
On Thursday, one Federal High Court for Kano bin issue one order to stop Kano state government from reinstating Emir Muhammadu Sanusi II.
Di court also pause di implementation of di new law wey cancel di four emirates of Bichi, Gaya, Karaye, and Rano.
Justice Mohammed Liman order say make all di parties wey dey involved maintain status quo pending di determination of one suit wey di Sarkin Dawaki Babba, Aminu Babba-Dan Agundi file.
Di suit dey challenge di recent actions wey Kano State government.
However, Oga Gumel don advise di pipo of di state to remain calm and cooperative as e add say anybodi wey do anyhow go see anyhow.
"Whoever, under whatever guise, we see dey plan to scata di state... go dey arrested and go face di full wrath of di law," e tok.
Security agencies involve afta di royal conflict for Kano take new turn.
Former Emir Aminu Ado Bayero wey di govnor bin remove from di position bin return back to Kano city on Friday night.
Di deposed Emir wit some of im supporters according to reports bin go di Emir palace. Wen di govnor get di informate say di former Emir don land di palace, im and some goment officials bin escort Emir Muhammadu Sanusi II go di Emir Palace for Gidan Rumfa around 1:00am on Saturday and na dia dem spend di night.
According to reports, di former Emir dey inside one royal palace for Nasarawa area of Kano city.
All dis drama dey happun afta di state govnor sign di Kano State Emirate Council (Repeal) Bill 2024 into law.
Di new law don replace di Kano State Emirates Council Law, 2019 and e dissolve di emirate councils wey Govnor Yusuf predecessor, Abdullahi Ganduje bin create.
Ganduje bin use dat law to split di Kano Emirate into five for December 2019 and remove di 14th Emir of Kano, Muhammadu Sanusi II, on March 9, 2020.
Di emirates wey Ganduje administration create na Karaye, Bichi, Rano, and Gaya, in addition to Kano.
However, on di streets of Kano, di reactions dey mixed.
One resident Idris SR Dawanau tell BBC on Friday: "I dey veri happy about di reinstatement of [Sanusi] today.
"I wish am well and hope e continue to contribute positively as e don always do."
But fellow resident Lawal Najeef condemn di move: "In my opinion, leaving all di emirs in place witout removing any for beta becos e make tins easier.
"For example, if you get one Emir nearby, pipo go fit carry dia issues go meet am witout having to travel far."